BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Covid-19 travel: India dey red, US dey amber, as Lagos do alert list for passengers

 118488133 Gettyimages 453487360 Lagos goment don comot alert list for kontries

Thu, 13 May 2021 Source: BBC

Di Lagos State goment for Nigeria don comot alert list for kontries based on how Covid-19 dey worry dia and wetin passengers need to sabi.

Di alert list dey three types: red, amber and green.

India, wey be di world second more populous, dey on di red list because according to Lagos, dem get coronavirus variant wey start from di kontri.

Amber colour na for kontries wey di variant enta from anoda place, and green dey reserved for all oda kontries.

Di city commissioner of health Prof Akin Abayomi release dis informate inside press conference wey e do on 12 May.

Dis dey come as Nigeria don begin enforce curfew and restrictions from Tuesday midnight 11 May, inside wetin di federal goment call "phase four" of dia programme to reduce coronavirus spread.

List like dis no be new tin and many kontries get am to epp passengers know di rules before dem travel. For instance, Nigeria dey inside UK amber list wey dem release last week.

As di commercial capital of di kontri, Lagos dey see thousands of travellers land from abroad everyday and dis fit be why di state decide to comot plans to counter wetin Prof Abayomi say na di incoming third wave of Covid-19.

All in all, Lagos put 16 countries inside dia red and amber list:

Red alert list

India

Turkey

Brazil

Amber alert list

Canada

U.S.A

France

Germany

Netherlands

Togo

Ghana

Cameroun

Angola

South Africa

Kenya

Uganda

Tanzania

Rwanda

Green alert list

All oda kontries

Different rules apply to passengers wey dey land Lagos based on which kontri dem from dey come. For instance passengers from 'red' kontries go isolate for 14 days even if dem test negative before departure, while those wey dey come from green kontries no get dis kain rule.

Prison sentence and fine

Prof. Abayomi tear warning give passengers say anybody wey break di State Covid-19 quarantine rules and instructions, fit chop fine of N300,000 ($731) and even collect 1 year prison sentence join.

E cite section 11 of new rule from di Lagos State Coronavirus Pandemic law, 2021 wey also say di executive governor get right to quarantine anybodi or joinbodi until im feel say e dey safe for di order to dey lifted.

Source: BBC