Di female corp member wey some vigilante group bin assault and tear her clothe for Anambra don come out to tell her own side of di story of wetin happun.
Operatives of di Agunechemba security for Anambra bin naked di girl and drag her outside afta beating and hitting her wit blow.
Di incident happun for Oba, Idemili South Local Govment Area of Anambra State, and e cause serious tok tok for social media.
According to di girl, she say di incident bin happun for 23 July 2025, around 5pm wen dem bin dey inside dia lodge for Anambra.
She say di men wey come her lodge bin begin use dia legs hit di door to break in, but wen she open to see who dem be, dem just carry gun dey shout but dem no wear any security uniform.
Di young lady give her account inside one video interview wey she do wit media personality Aproko King, wia she narrate di incident give am.
She say she bin dey inside di lodge wit her oda corpers for di three storey building wey get plenti flats, wen heavy knocks begin dey land for dia door.
According to her narration, she say di door for hit her wen she wan go open am to see who dey use aggression hit am, if no be say she dey jeje.
"I see masked man wit gun. E no dey wear any form of uniform, notin to take identify dem. At first, I bin fear say na armed robber until I hear am say, "all of you, outside".
She tok say she find courage ask di man say why e want make all of dem come outside, as e no introduce imsef or tell dem di reason why e come dia lodge.
"All of us na corpers for di room. E no tell us wia e dey come from or introduce imself. My colleague bring im ID and tell odas make dem bring dia own too, but dem ignore us.
"Dem force dia way into our rooms, search laptops and phones. Dem become aggressive and say we dey do yahoo."
Di female corper say dem try explain to di men say dem no be yahoo, say dem dey serve, but di men no gree.
She say na nine of dem di vigilante men bin carry dat day and all of dem na corpers dem be.
She say wen di men search dem, dem no find anytin and dem even show di NYSC portal for dem to see sake of say some just come for dia place of primary assignment.
"But dem push us downstairs. Dem ask me why I bin dey challenge dem as woman. Wen we reach downstairs, we see dia vehicle and realise say dem be Anambra vigilante group."
"Even if we we go go wit dem to dia office, we suppose call our LGI so dem go know, since we no sabi wia dem dey take us go."
She narrate say di men of di vigilante group no allow dem call anybody and dem begin beat her say why she go ask dem kwesion.
According to di corper, she beg dem make she change her cloth but dem refuse and force her into dia vehicle, afta dem also beat some oda corpers wey chook mouth for di mata.
"Dem start dey beat me, say wetin give me di right to kwesion dem. Dem say dem go smash our phones if we call anyone. Dem beat me, tea my clothes. One of my colleagues bin dey beg on my behalf, but dem hit her wit iron rod."
From di video wey go viral, we see how di men bin drag her clothe till e tear and still dey push her up and down.
For her side of di story, di female corper say di vigilante men bin call her ashawo say dem go shoot her and throway her bodi.
"Dem slap me, call me prostitute. Dem threaten to shoot me and throw my corpse for bush."
Now, di young lady dey ask say she must get justice make all dose vigilante pipo get punishment.
Meanwhile, Anambra State govment don dismiss di eight Agunechemba operatives wey dey involved for di assault on di female member of National Youth Service Corps (NYSC) wey bin dey serve for di state.
Dem parade di operatives for front of Agunechemba Security Command for Anambra state, wia dem go from dia land for police hand for more investigation.
Di incident wey go viral for social media bin vex plenti Nigerians wey demand say dem must get justice for di lady wey dem assault.
Also, di National Youth Service Corps (NYSC) condemn di "unacceptable and dehumanising" attack on di corpers.
Caroline Embu di Acting tok-tok pesin for statement say dem believe in and support di ongoing investigation by di Nigeria Police Force to find out wetin happen.
"Dis we trust go help get justice for di Corps Member in kwesion and any oda aggrieved party,", Embu tok for statement.