Ukraine President Volodymyr Zelensky
Russian missile and drone attacks for Ukraine capital, Kyiv don kill at least eight pipo and wunjure 77.
Di city mayor, Vitali Klitschko say fires bin start sake of falling drone wrecks as fears still dey say pipo don hook under di rubbish.
E add say, "fire start for six areas" even as e add say "pipo dey under di doti" of one collapsed residential building.
Na di deadliest Russian attack for di capital city since July. Dis na as attacks for oda parts of di kontri bin involve 11 ballistic missiles, 55 cruise missiles and 145 drones.
Ukraine President Volodymyr Zelensky don cancel part of im trip to South Africa bicos of di attack, even though im go still meet President Cyril Ramaphosa.
US President Donald Trump don call out di way Zelensky dey approach peace tok-tok.
Afta Zelensky insist say Ukraine no go accept Russia to occupy Crimea, Trump say dey "very harmful to di peace negotiations".
Trump add say, "e fit get peace or e fit fight for anoda three years bifor im lose di whole kontri. Di statement wey Zelensky make today go do nothing but prolong di killing field."
Meanwhile President Zelensky dey for South Africa wey go be im first visit to Africa since im bicom president for 2019. Although e bin do small stopover for Cape Verde for 2023.
E don dey inside private meeting wit President Cyril Ramaphosa togeda wit political, civil and student representatives for African kontris.
For post for X, Zelensky tok say, "e dey important to bring just peace closer. We dey work to make sure say di G20 kontris dey actively engaged for diplomatic efforts".
BBC tori pesin, Mayeni Jones torchlight why di meeting wey go dey impossible just two years ago dey happun now. Dis na as at dat time South Africa no gree condemn Russia invasion of Ukraine.
But she explain say, "di geopolitical landscape don change and both kontris now get plenti tins in common. As both dey clash wit Washington".
She add say Ukraine wan increase dia international partners especially wit Africa wia many kontris get strong links wit Russia.
President Zelensky say e go comot South Africa immediately afta e meet wit Ramaphosa and na di foreign minister of Ukraine go handle di rest of di trip.
Zelensky add for post ontop X say Russia bin sama Ukraine wit almost 70 missiles overnight, including ballistic and about 150 attack drones.
Reactions from victims of di attack na mostly vex wit di West and how dem dey silent oa di attack.
Lilya Yadamenko, 52, wey live opposite di building wey collapse bicos of di strike for Kyiv tell BBC say she dey vex wit wetin dey happun.
She say, "dis kain crimes against civilians dey committed wit di silent consent of di Western world.
"My message to di West na say we dey live for di same planet, we all dey connected politically and energetically and to tolerate crimes like di ones wey Russians dey do against civilians for Ukraine go affect di whole humanity".
Meanwhile, Russia dey accuse Kyiv say dem scata di pause for attack on energy infrastructure and di Easter ceasefire wey dia foreign minister say na Moscow declare.
Foreign ministry tok-tok pesin Maria Zakharova say e show say, "Zelensky no fit keep agreement".
Dis na as Ukraine and Russia don accuse demsefs say dem scata di 30-hour "Easter agreement" wey Russian President Vladimir Putin bin announce on Saturday wey don expire.