Country

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Menu
Country

#FindHinyHumoren: How police arrest man wey allegedly rape, murder 'missing' Iniobong Umoren

 118300026 Ini Di late Miss Iniobong Umoren

Mon, 3 May 2021 Source: www.bbc.com

Di Akwa Ibom State Police Command don arrest 20 year old Uduak Frank Akpan for di suspected kidnap, rape and murder of Miss Iniobong Umoren.

For Statement wey di Police tok tok pesin Odiko Macdon sign say men of di Anti-Kidnapping Squad of di Command from dia investigation arrest di suspect, Uduak Frank Akpan and im confess how im lure di victim, Miss Umoren to im house say im wan give her job but come sexually and physically assault her till she die.

To hide wetin im do, im drag and bury her for im papa compound but di police don exhume di deadibody and put am for University of Uyo Teaching Hospital UUTH for autopsy.



Im emphasise say di suspect bin don confess to im local goment chairman of wetin im do before im run go Calabar and nobody hand am over to di police and dem go charge am go court after dem finish dia investigation.

On 29 April @UmohUduak begin use #HinyNumoren to announce say her friend dey in trouble and she need help.

Uduak wey her twitter handle be Happiness Activist say her friend tell her say she dey go for one job interview for Airport road on April 29th, and she no return since then.

She say di interview venue dey very far from her house.

Source: www.bbc.com
Related Articles: