Police for Lagos don arrest popular actor Olarenwaju James A.K.A Baba Ijesha sake of say e allegedly defile 14 years old girl.
For statement police tok tok pesin Muyiwa Adejobi say CCTV capture di 48 years actor as e dey carri out di act for di house of victim.
From police findings, dem say di actor don dey allegedly defile di girl since di age of 7.
Police say di actor don confess to di crime and dem don begin do dia own investigate.
Baba Ijesha na nollywood actor wey don act major movies for Nigeria and e dey very popular for southwest of di kontri.
As dat one dey trend, police for Oyo state announce in Thursday say dem don arrest one school teacher for Ibadan say e defile im 12 years old pupil.
Police say 30 years old teacher Olawuyi Ebenezer don dey do di tin to di small girl plenti times.
Tori of rape and defilement don dey become sometin to worri about in recent times for Nigeria as plenti popular and unpopular pipo don dey fall into di crime.
- Ending child marriage: Victim attempted suicide
- Teacher defiles minor, bribes her with ¢20 cedis
- Man defiles, impregnates 15-year-old girl in a mosque
- Ajumako Essasan chiefs, elders forcing 14-year-old defilement victim to abort pregnancy
- Shatana appointed ambassador to help fight nudity, prostitution and child abuse in Ghana
- Read all related articles