BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Godwin Emefiele dey face fresh criminal charges as arraignment dey shele for court today

Screenshot 2024 05 15 121844.png Dis na di fourth set of criminal charges wey di Nigerian goment dey bring against di former CBN oga

Wed, 15 May 2024 Source: BBC

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) go arraign former govnor of di Central Bank of Nigeria, Godwin Emefiele, bifor di Federal Territory High Court Abuja on Wednesday 15 May on anoda set of criminal charges.

Emefiele go appear bifor Justice Maryann Anenih, dis time on a four-count allegations of illegal printing of naira and unlawful withdrawals from di consolidated revenue fund.

According to di EFCC, di former CBN oga disobey di CBN Act wen e bin approve di printing of a total of N684.5 million for di cost of N18.96 billion, witout approval from di president of di Federal Republic or recommendation of di Board of Central Bank.

Dis no be di first criminal charge wey di Nigerian goment dey bring against Emefiele who be oga kpatakpata for CBN for almost 10 years; March 2014 to June 2023.

One man, four criminal charges, ova N350 million in bail

Di first charge against Emefiele na allegation of illegal possession of firearm wey di DSS bin file bifor Justice Nicholas Oweibo of di Federal High Court for Lagos for July 2023.

Di case linger reach August bifor di DSS apply to withdraw di mata sake of "emerging facts" wey require "further investigation", but dat na afta Justice Oweibo bin don grant Emefiele bail in di tune of N20 million, but di DSS no release am.

Den for November 2023, di EFCC file a a six-count amended charge bifor Justice Hamza Muazu of di FCT High Court, wey accuse di former CBN oga of illegally buying 43 vehicles between 2018 and 2020 at di cost of ova N1.6 billion.

Justice Muazu later grant Emefiele bail on dis mata for N300 million and two sureties in like sum.

Suit number three na 26-count charge wey di EFCC file for April of 2024, bifor Justice Rahman Oshodi of di Special Offences Court, Ikeja, Lagos, wia dem accuse Emefiele and one Henry Omoile of corruption and magomago wey pass $4.57 billion and N2.8 billion. Again, Justice Oshodi grant Emefiele bail at N50 million.

Di fourth criminal charge na dis fresh arraignment wey go happen on Wednesday bifor Justice M. Anenih of di FCT High Court, Maitama.

Emefiele palava

Godwin Emefiele begin enta news for late 2022 wen im fliers and posters bin comot say e wan run for president for di 2023 general elections, but e deny am.

Den, di former CBN oga begin introduce some policies wey no go well wit Nigerians. One of dem na di naira redesign policy.

Dis policy change di colour of di N200, N500 and N1000 naira notes, and put restriction on how much pipo fit withdraw from bank as cash - N20,000 per day.

Di development bin cause gbege and suffer across Nigeria bicos naira bin dey veri scarce, and e bin cause protests and deaths for some parts of di kontri.

Na di Supreme Court later overturn di policy and extend di deadline for di old naira notes.

President Bola Tinubu no waste time to suspend Emefiele in di first few days as e resume office, and afta dat, di Department of State Services (DSS) confam say e dey dia custody.



Emefiele bin deny rumours say e bin wan run for President in 2023 even wen e neva resign as CBN govnor

Source: BBC