BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Slovak PM Fico dey hospital afta pesin shoot am

495d8e20 12c5 11ef B9d8 4f52aebe147d Slovak PM Fico

Wed, 15 May 2024 Source: BBC

Slovak Prime Minister Robert Fico wound afta pesin shoot am, according to local media reports.

Dem shoot Oga Fico as im bin dey greet crowd of pipo in front of one cultural community centre for one town wey dey for Handlova, na dia one goment meeting dey happun, na so di tori tok.

According to journalist wey bin dey dia wen e happun dem say dem hear several shots.

Di Slovak leader dey hospital and police say dem don detain di alleged atacker.

Handlova dey around 180km (112 miles) north-east of di capital Bratislava.

One witness bin tell di Dennik N website say she hear three or four shots and see Oga Fico fall for ground. She see wounds for im head and chest.

Im security pipo bin bundle am enta ca, and local reports say dem carry am by helicopter to one nearby hospital.

One video show plenty men wey bin dey rush to detain di suspect just outside di cultural centre for Handlova. BBC no fit verify di footage yet.

Slovakia outgoing president Zuzana Caputova react to di shooting say she dey shocked by di "brutal and ruthless" attack on di prime minister, add say she wish am strength to recover.

Oga Fico return to power for Slovakia afta last September elections, as di head of one populist-nationalist coalition.

Im first few months as prime minister get as e be. For January im halt military aid to Ukraine and last month push through plans to abolish public broadcaster RTVS.

Dis na breaking news story we go dey update am. Abeg refresh di page for di fullest version.



  • Shinzo Abe assassination, how dem kill Japan ex-Prime Minister
  • Why Melinda French Gates dey resign from di Bill & Melinda Gates Foundation


Source: BBC