BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

America highest court go rule if Trump fit run for president

29391838 Donald Trump bi former president of America

Sat, 6 Jan 2024 Source: BBC

Di US Supreme Court don tok say dem go hear one historic case to determine weda Donald Trump fit run for president.

Di justices don agree to take up Oga Trump appeal against one decision by Colorado to remove am from di 2024 ballot for dat state.

Dem go hear di case for February and di ruling go apply nationwide.

Lawsuits for a number of states dey seek to disqualify Oga Trump, dem argue say e engage for di insurrection wey happun during US Capitol riot three years ago.

Di legal challenges dey hang on weda Civil War-era constitutional amendment render Oga Trump ineligible to stand as candidate.

Di Supreme Court decision to hear Oga Trump appeal come afta attorneys general from 27 states filed one brief wey ask di court to reject Colorado ruling.

Di 14th Amendment of di US Constitution don ban anyone wey "engage for insurrection or rebellion" from holding federal office, but di former president lawyers argue say dat law no apply to di president.

Im lawyers argue say: "Di Colorado Supreme Court decision go unconstitutionally exclude millions of voters for Colorado and dem fit likely use am as template to disenfranchise tens of millions of voters nationwide."

Oga Trump don also appeal against one decision by electoral officials for Maine to remove am from di ballot.

Following di Supreme Court announcement on Friday, Colorado Secretary of State Jena Griswold tok say she don certify di state ballots for di upcoming presidential primary elections and Oga Trump name dey on dem.

Di primary ballots, wey go hold in each state, go help determine which presidential candidates go run for di November election.

Colorado primary dey set for di beginning of March - soon afta di Supreme Court decision on Oga Trump case.

"Di United States Supreme Court don accept di case, and Donald Trump go appear on di ballot as a result," Ms Griswold tok for one statement.

Di split 4-3 decision by Colorado high court last month mark di first time for US history wey dem go use di 14th Amendment disqualify a presidential candidate from di ballot.

Dis na di first time di Supreme Court go consider how to interpret di clause.

Oga Trump na di current Republican front-runner for one likely rematch against President Joe Biden, wey be Democrat, for dis November election.

Courts for Minnesota and Michigan don dismiss attempts to disqualify Oga Trump. Other cases, including di one for Oregon, still dey pending.

Di US Supreme Court get one conservative majority - with three justices wey Oga Trump appoint wen e be president.

But dem rule against am well-well for im lawsuits wey challenge im defeat to Oga Biden for 2020.

Di court on Friday agree to fast-track di case, dem schedule oral arguments for 8 February.

Oga Trump legal team get until 18 January to file dia opening brief.

Di group wey dey argue for Mr Trump disqualification must submit dia argument by 31 January.

Di involvement of di top US court don draw comparisons to di 2000 presidential election between George Bush and Al Gore, wey end for lawsuit for di Supreme Court.

Di conservative-majority court decision to pause Florida vote bin handover victory give Oga Bush.

Cases for di Supreme Court normally dey take between four and 12 months - in contrast wit di few weeks wey di justices currently schedule.

Di timeline makes am likely say di court go issue judgement ahead of di Super Tuesday primary election for March, wen Colorado plus many oda states go hold dia election to decide on each party candidate for president.

Wetin happun for US Capitol riot

On di day of di US Capitol riot, supporters of Oga Trump bin storm Congress as lawmakers dey certify Oga Biden election victory.

Dat day di then-president bin hold one rally outside di White House wia e bin repeat false claims of mass election fraud as e encourage protesters to "fight like hell", but also to march "peacefully" go di Capitol.

Oga Trump critics argue e suppose dey disqualified no be only for im actions during di riot, but for im and im campaign efforts to overturn di election result in Republican-aligned states wia e lose.

While Oga Trump allege say efforts to sabotage di outcome of di 2020 presidential election na di focus of trials for federal court and one state court for Georgia, dem neva charge am criminally wit accuse say e incite insurrection for either case.

Source: BBC