BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Gospel singer Nathaniel Bassey say make police punish four pipo wey say im dey responsible for Mercy Chinwo pikin

Nathaniel Bassey, Mercy Chinwo.png Nathaniel Bassey bin visit Mercy Chinwo and her husband afta dem born dia pikin

Wed, 3 Apr 2024 Source: BBC

Popular gospel singer and instrumentalist, Nathaniel Bassey, don write to di Inspector General of Police ova four pipo wey dey write criminal tin about am online.

Nathaniel Bassey write to IGP Kayode Egbetokun say make dem prosecute di four pesin wey im don identify say dem defame am say im be di father of pikin of anoda gospel minister, Mercy Chinwo.

Last week, some pipo bin dey share screenshots of posts wey dey carry informate about di gospel singer say di pikin of Mercy Chinwo bin resemble am.

Dis na afta Mercy Chinwo Blessed and her husband bin post di picture of dia pikin for different social media platforms on Friday 29 March 2024.

Di singer say dat kain lie fit break marriage and doz wey dey behind di post suppose serve as lesson to odas.

Nathaniel Bassey through im lawyers Peter Abraham, Uche Matthew, Gbenga Agunloye, and Anthony Abia bin write one petition to di IGP on 1 April 2024, according to local tori pipo Channels.

Di four pipo wey dia name dey di petition na Okoronkwo Ejike, Kingsley Ibeh, Terrence Ekot and Dj Spoiltkid. Di lawyers say make police begin dey treat di mata as urgent.

According to di petition, Nathaniel Bassey dey sad and dey very disturbed to find say di four suspects get criminal intention to destroy im image and character.

Wetin pain di gospel singer be say di post wey trend online dey accuse and call am “di father of minister Mercy Chinwo Blessed son,’ woman wey dey married to anoda man”, dem tok.

“Our client na gospel music minister wey im songs and ministrations don impact di life of so many pipo around di world” di lawyer write for di petition.

“Di post by Mr. Okoronkwo Ejike don go viral and reaction from di post by Mr. Kingsley Ibeh bin comment on di post of Mr. Okoronkwo wit one picture of minister Bassey and im come add di caption “Di real father of di baby.”

Di petition tok say one X user “Dj SpoiltKid” wey dey verified bin quote di statement wey Okoronkwo Ejike bin write, im come add screenshot of di post and add, “Wen we go do di DNA test?”

Same tin wit Mr. Terrence Ekot for X wey tok say Mercy Chinwo son and Nathaniel Bassey resemble sake of say both of dem bin don do different projects togeda bifor.

Di lawyers say dis posts by di four of dem na to destroy di image of dia client (Nathaniel Bassey) and if dem no deal wit dem, dem go kontinuu to dey destroy di good name of di gospel minister.

Di lawyers say di actions of di four individuals dey against sections 373 and 375 of di Criminal Code Act and Section 24(1)(b) of di Cybercrimes (Prohibition, Prevention, etc.).

“We wan make you use your good offices to investigate dis matter, arrest, and bring di suspect to justice, wey go serve as lesson to odas.”

Nathaniel Bassey na di convener of di popular #HallelujahChallenge wia pipo dey pray and praise for midnight.

Nathaniel Bassey bin visit Mercy Chinwo and her husband afta dem born dia pikin and return to Nigeria for 2023.

Source: BBC