Africa

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Opinions

Country

Chibok kidnapping: Nigerian presidency say dem still get di girls for mind, 7 years later

 118051414  97798198 Chibokgirls Na on 14 April, 2014, gunmen bin enta di school for Borno State and pack di students

Thu, 15 Apr 2021 Source: www.bbc.com

Di Nigerian Presidency say dem still dey work to find di remaining missing girls from Chibok, Borno State.

Dis na as seven years don pass since Boko Haram bin kidnap 276 school students from di Goment Girls College, Chibok.

For statement, dem say di plan to release di remaining 112 girls wey still dey miss, still dey go on.

Di goment dey get hope on top say, "di recent decisive push wey di miltary do against terrorists dey give hope say breakthrough dey possible and e fit happun anytime soon."

Dem still add say make kontri pipo dey pray for di military for di work wey dem dey do to end di insurgency for di kontri and free all di citizens wey dey hostage.

Na on 14 April, 2014, gunmen bin enta di school for Borno State and pack di students, sometin wey bin make world wide news and start di call for #BringBackOurGirls.

Following dat kidnap, many more don happun including di Dapchi kidnap for 2018 wey Leah Sharibu still dey in captivity, 300 students for Jangebe for Zamfara state.

Source: www.bbc.com