Africa

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Opinions

Country

'Marriage' in Nigeria: New guidelines for 'conduct of statutory marriage'

 116032486  116029556 424ac55f 63d8 4c35 Aa1b 994f47cd0f86 Goment recently launch 20 new federal marriage registries

Mon, 10 May 2021 Source: www.bbc.com

New guidelines don dey for di conduct of Statutory Marriage for Nigeria.

Di Minister of interior, Rauf Aregbesola give dis informate for di 2021 National Stakeholders Conference on di Administration of Statutory Marriage.

Di minister for di conference add join say di ministry don also amend Legal Notices for di Marriage Act.

Permanent Secretary for di interion ministry, Dr. Shuaib Belgore na represent oga Aregbesola for di conference.

According to oga Belgore, di amended Legal Notices don change di pattern of di administration and conduct of statutory marriages for di kontri.

He say di Minister believe say wit di amended act and if couples follow all di rules wey guide marriage, di plenty marriage kasala wey dey face marriages go reduce.

E add join say di amended legal notices don put to rest di kwanta wey dey always happun between di Ministry and di Local Government Registrars of Marriage as dem don design Local Government Areas and Area Development Councils of di Federal Capital Territory as Marriage Districts.

According to di minister, di better thing about dis arrangement na di services wey di ministry dey offer through di Marriage Registries go dey close to di pipo as dem no go need travel long distance before dem fit marry for any Federal Marriage Registry.

Five things to know about di new guidelines wey follow marriage for Nigeria:

Di Ministry of Interior na im go dey responsible for di conduct of statutory marriages for Nigeria, plus giving permission of di public places of worship where pipo fit celebrate dia weddings.

Dis na as di minister approve di establishment of 20 new Federal Marriage Registries and efforts dey go on to get Federal Marriage Registries for all di state capitals of di federation.

  • Di Ministry of Interior don create Enforcement, Inspection and Investigation (EI&I) division and dia work na to ensure say Places of Worship and Marriage Registries follow wetin dey inside di Marriage Act, for couples to fit enjoy pleasant marriage experience.


  • Only di Ministry of Interior get authority to give licences to public places of worship to conduct legal marriage for Nigeria.
  • Local goment councils wey dem recently design as Marriage Districts, go fit choose officers as local goment registrars of marriage now.


  • Di ministry go dey supervise di activities of Local Government Registries and ensure say dem provide better premises for di conduct of statutory marriages.


  • Di printing and issuance of Marriage Certificate Booklets to licensed Places of Worship and Marriage Registries na di sole responsibility of di Principal Registrar of Marriages.


  • Source: www.bbc.com