100 students were abducted from St Mary's Catholic School for Papiri.
Di Chairman of di Christian Association of Nigeria (CAN) for Niger State, Bishop Bulus Dauwa Yohanna, and di Niger State Commissioner of Police, Adamu Abdullahi Elleman, don confam to BBC say, dem don receive confirmation say security forces don rescue 100 abducted students from St Mary's Catholic School for Papiri.
Dem tell BBC say di information come from di Office of the National Security Adviser and say di children go dey released in batches to dia parents from Monday.
Di National Security Adviser, Nuhu Ribadu bin visit Papiri last week and meet wit a delegation wey di state CAN chairman wey also be di school proprietor, Bishop Yohanna lead.
For dat meeting, e bin assure dem say di children go soon dey rescued and reunited wit dia families.
A total of 165 pipo including students still never dey accounted for from dat kidnapping.
Di Catholic Diocese of Kontagora for Niger State bin release a list of pupils and staff wey dey for bandits hand after di attack on di school.
Di diocese bin tok say di new list wey dem release on November 24 show say 265 pipo still dey captive for bandit hand.
Di breakdown include five teachers, seven non-academic staff, 14 secondary school students and 239 nursery and primary pupils.
Na on Friday, November 21, 2025, armed men invade di school community and kidnap di students and staff.
St Mary's school na private boarding school for primary and secondary.
Di school dey mixed wit boys and girls.
Tori be say di attackers bin carri plenty motorbikes and vans to take carri out di attack.
Di Niger State school abduction hapun just days afta gunmen bin abduct students for Kebbi State and worshippers for Kwara State.
One Mrs Sunday wey narrate di incident to di BBC say "two of my sister children follow for pipo wey dem abduct for di school. She get four children for di school, dem abduct dem for midnight. One dey primary six, di oda one dey nursery three, six years and thirteen years."
She bin say di children mama dey bush since morning dey cry, say soldiers bin get opportunity to go rescue di children for road wen di motor wey carri dem spoil for road.
"Na majorly di primary school girls dem carri, di secondary students manage to escape. dem dey trek, small small children six years, four years, 10 years, 13 years. osldiers come here early morning, pipo from di bush tell dem say dem dey close, make dem go rescue dem" na so she tok.
Di Niger State school attack for Awara local govment inside Niger State hapun about 140 kilometres from wen di Kebbi school kidnap take place for Wasagu Local Govment Area.