Leader of di pan Yoruba socio-political group, Afenifere, Chief Ayo Adebanjo
Di leader of di pan Yoruba socio-political group, Afenifere, Chief Ayo Adebanjo don die.
Tori be say e die at di age of 96.
Adebanjo na ogbonge leader of di Yoruba pipo for south west Nigeria and e dey always join chook mouth for di mata of a Yoruba nation wey some pipo bin dey ask for.
Di tok tok pesin for di Afenifere group, Jare Ajayi, confam di news of Adebanjo death to BBC Yoruba, on Friday 14 February.
According to tori, Adebanjo pass away for im residence for Lekki, Lagos State.
Chief Adebanjo dey among di pipo wey dey call for restructuring for Nigeria.
For 2021, for one exclusive interview wit BBC Pidgin, Adebanjo say failure of goment to protect di kontri pipo among oda tins make di youths from different regions want comot Nigeria.
E add say Afenifere no want make di kontri divide but di president must dey ready to return di kontri to true federalism.
According to Adebanjo, restructuring be di only solution wey fit solve all di problems wey dey face Nigeria including di security wahala .
''We no go stay for Nigeria under dis constitution. Na restructuring or separation'' e bin tok.
Di Afenifere leader further tok say if di president restructure Nigeria, pipo wey dey call for separation go stop.
Who be Chief Ayo Adebanjo
Adebanjo na lawyer and one ogbonge politician and nationalist wey no dey gree until e do tins.
Dem born Chief Adebanjo for Isanya Ogbo, one village wey near di current day Ijebu Ode for Ogun State, South-West Nigeria.
Na on 10 April, 1928 dem born di late African nationalist, bifor e die for 2025.
E practice journalism bifor e go study law for UK.
Im journey for politics get strong leg especially for di Yoruba part of Nigeria, as e begin at a veri early age of im life.
E be correct follower of late Nnamdi Azikwe wen e dey join struggle for 1943 and dat make one a veri strong voice.
E later become a member of Action Group wia Chief Obafemi Awolowo dey lead, na from dia e become believer of di 'Awo' movement.