BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

African kontris wey don dey close to World Cup finals

73891919 Morocco be first African country to qualify to World Cup semi-finals stage

Sun, 11 Dec 2022 Source: BBC

Morocco don become di first African kontri in history to reach di World Cup semi-finals.

Dis na afta di Atlas Lions beat Portugal 1-0 on Saturday, 10 December 2022.

Youssef En-Nesyri score di winning goal in di 42nd minute to kontinu Morocco unpredicted performance for di Qatar 2022 Fifa World Cup.

Dia semi-final qualification don bring plenty pride to di African continent and di Arab world for di tournament wey dey happun for di first time for di Middle East.

Oda African kontris including Algeria and Nigeria don also make dia mark for di World Cup but dia effort no reach.

List of Africa kontris wey don reach quarter finals of di World Cup

Di Fifa World Cup tournament na di toughest football competition for African kontris.

Before Morrocco, di highest Africa kontris don reach for World Cup na di Quarter final stage – and na only three kontris bin don reach dat level.

Di kontris na;

Cameroon: Di West African kontri reach di quarter-final stage of di 1990 World Cup for Italy.

Na England comot dem wen di match enta extra time.

Senegal: Anoda West African kontri try carry di continent reach Quarter final for di 2002 World Cup.

Na Japan and South Korea jointly host di tournament wey be di first time di Taranga Lions dey play for World Cup.

Senegal beat France, den draw wit Denmark and Uruguay.

Dem also beat Sweden during extra time for di round of 16, before losing to Turkey for di quarter-finals.

Ghana: Di Black Stars na di third African kontri to advance to di quarter-final stage of di Fifa World Cup.

Na anoda West African kontri wey don perform well for di history of di World Cup.

Na for di South Africa 2010 tournament wia Ghana lose 4-4 to Uruguay on penalties.

Wetin Morocco semi-final qualification mean for Africa

In all of di attempts wey Africa don make na Morocco don come break di record.

Di qualification of Morocco mean sometin for Africa ahead of future World Cup competitions.

Fifa neva make am clear but sabi pipo for di sports say Africa fit get more slots for di 2026 Fifa World Cup sake of Morrocco performance.

Source: BBC