Pipo seen for front of Agunechemba Administrative Headquaters
Anambra State govment don dismiss di eight Agunechemba operatives wey dey involved for di assault on di female member of National Youth Service Corps (NYSC) wey bin dey serve for di state.
Dem parade di operatives for front of Agunechemba Security Command for Anambra state, wia dem go from dia land for police hand for more investigation.
Di incident wey go viral for social media bin vex plenti Nigerians wey demand say dem must get justice for di girl wey dem assault.
Wit di video wey go viral for social media, di security operatives of di Agunechemba wit dia guns bin join hand beat di young female corps member wit slaps, blows and di girl dey shout 'please' but dem no leave her.
Afta different Nigerians including NGOs, politicians, police and even NYSC demsef chook mouth for di mata, di vigilante group don take step to remove di operatives wey carry out di operation and hand dem ova to di police.
According to di special adviser to Govnor Soludo on Community Security for Anambra State, Ken Emeakayi wey make di announcement for di state broadcasting station, e say dem no dey cova di mata up.
According to di special adviser to di govnor of Anambra wen e dey tok for Anambra Broadcasting Service on Wednesday 20 August 2025, e say dem no dey sweep di mata under carpet.
"In readiness for openness and to dey fair to evribodi, we dey hand dem ova to di police. Dat na wetin we dey do, na di reason why we bring dem out make pipo see dem. We no dey hide dem
E add say Anambra state govnor no support make any security outfit bin dey assault anybodi for di state.
"Pipo dey tok say we dey try sweep dis under di carpet, dat no be wetin we dey do. Di govnor of Anambra no send us out to molest anybodi," e tok for di video.
Wetin happun bifor
Di young lady dey identified as corps members for Anambra State wen vigilante operatives bin assault and tear her clothes..
Inside di video, men wey wear mufti wit heavy guns bin enta into one compound and begin beat one lady. Dem tear her clothes and drag her left and right till dem push her out.
Di incident happun for Oba, Idemili South Local Govment Area of Anambra State, and e don cause serious tok tok for social media.
Di National Youth Service Corps (NYSC) condemn di "unacceptable and dehumanising" attack on di corpers.
Caroline Embu di Acting tok-tok pesin for statement say dem believe in and support di ongoing investigation by di Nigeria Police Force to find out wetin happen.
"Dis we trust go help get justice for di Corps Member in kwesion and any oda aggrieved party,", Embu tok for statement.
She add say "Furthermore, necessary administrative procedures dey go on to assist di Corps member to manage di physiological and psychological trauma resulting from dis unfortunate incident."
According to di police for Anambra State, na di Agunechemba Vigilante Group bin carry out di assault. Dem add say di incident no be recent one as e don happun for July 2025.
However, Anambra authority condemn di act and describe am as unfortunate incident wey no suppose happun.
Anambra authority react to assault video
Di special adviser to Govnor Soludo on Community Security for Anambra State, Ken Emeakayi don react to di trending video wia vigilante operatives bin assault di female corps member and odas.
E say di operatives bin dey carry out operation wen di incident happun but e dey veri sad say dat kain tin happun.
"Wetin happun for dat incident dey veri unfortunate. We no rule out dis unfortunate incident wey happun, we get di report and di step we take be say we arrest di operatives wey dey involved for di act."
"We detain dem, invite di victim wit di NYSC state coordinator. Den we say, our men wey go dat place, dia action dey unacceptable."
Di special adviser to Anambra State govnor tok for di interview wit Channels TV say na men of di local security outfit Agunechemba bin carry out di operation.
E say dem bin dey pursue some suspected cultists wey run inside di compound wey di mata happun.
According to Emeakayi, Udo Ga-Achi na di operational code name wey di operatives dey take carry out di operation.
E say di operation get di police, DSS, army, civil defence and all di security agencies for Anambra State but Agunechemba na di state security outfit wey be say na homeland security law create am.
According to di community security adviser for Anambra State, na di law of di state empower di Agunechemba security outfit "to enta any compound wey any questionable pesin run into wen dem dey pursue am".
E say di Agunechemba security outfit fit form squad for di purpose of tackling kidnapping, banditry, cultism, and any oda vices.
For dis video wey dem naked di female corps member and beat odas, e say di Agunechemba security outfit bin purse suspected cultists into di compound and dem begin search di building.
E say na wetin carry di operatives go dat building be dat.
"Di Agunechemba for Oba town bin dey chase group of cultist guys wey dey ride for motorcycle. During dat period, di suspected cultist run into one isolated area and into some houses."
"Di operatives pursue dem into di compound, wia some pipo run into different houses and di operatives enta dia to bring dem out to screen and identify dem."
However, e condemn di action of di security operatives wia e tok say dat assault no suppose happun.
'We don sabi di suspects' - Police
Meanwhile, di Anambra State Police Command don condemn di sad incident wia vigilante bin naked di young female corps member.
"Di assault dey carried out by vigilante operatives. Following di incident, we don identify di suspects wey dey involved," Anambra State police tok-tok pesin, SP Tochukwu Ikenga, tok for statement.
E say di reason why di case neva move forward since e happun na becos say di victim dey unavailable.
Ikenga also say dem don begin investigation into di case, and dem no go gree for any form of assault becos say na criminal offence under Nigerian law.
"Any form remain criminal offence under di Nigerian law and get di right to take necessary legal action to help di court proceedings while we dey wait for di victim."
Police also cut warning give vigilante groups say make dem stop dey use brutality and abuse of authority during dia operation.