BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Andrew Tate no get bail from Romania detention

17766174 Andrew Tate (middle) dey arrested by Police

Wed, 11 Jan 2023 Source: BBC

Controversial British-American internet influencer don fail to get bail for Romania.

Tate wey dem bin arrest wit im brother Tristan last month on accuse of human trafficking and rape, wey dem deny.

Authorities suspect di two brothers wit two oda Romanian citizens say dem dey run "organised crime group".

Police go kontinu to hold di group for di 30 day period afta court reject di appeal on Tuesday.

Oga Tate look like e bin dey carry Quran enta di Bucharest Appeal Court as dem cuff am with im brother.

Afta di 29 December arrests, police say dem don find six pipo wey dey allegedly "sexually exploited" by wetin dem call "organised criminal group".

Police tok say na di British citizens dey "recruit" di victims, who dem say no tok clear and bin pretend say de wan enta relationship with di victims.

Dem dey call dis kain bobo juice "di loverboy method".

A statement allege say dem go later force di victims to di porn wit threat of violence.

Di Tate brothers lawyer, Eugen Vidineac, say im client don deny all di accuse.

Who be Andrew Tate

Dem born Tate for di United States before im move to di United Kingdom wia di 36 year old bin get successful kickboxing career.

For 2016, dem comot am from di British version of Big Brother afta video comot wey look like e dey attack woman.

Afta dat, e start "webcam business", wey im call "adult entertainment".

E turn bad boy worldwide as Twitter ban say im tok say make women "bear responsibility" for rape, dem don put am back.

But even wit all di social media bans, e still get followership of young men, wit im ova manly, jolly-jolly lifestyle.

Source: BBC