Menu

Anthony Joshua vs Jake Paul: All you need to know about di fight

Hohii.png Evritin don set for di ogbonge fight betwin Anthony Joshua Jake Paul

Fri, 19 Dec 2025 Source: BBC

Evritin don set for di ogbonge fight betwin Nigerian-British former boxing heavyweight champion, Anthony Joshua and social media sensation-turned boxer Jake Paul.

Dis fight don cause plenty tok-tok since dem announce am in November, as some boxing sabi pipo say na one-sided match e go be sake of say Joshua don be world champion several times while Jake Paul since e start professional boxing neva even fight any serious contender.

Odas say Joshua agree to di fight just for di money wey go dey involved, but di two-time heavyweight champion say even though money folo for why e agree to di fight, e dey also do am for legacy sake.

Jake Paul bin don claim for social media say di money wey dey involved for di fight go reach about $267m.

Both men don dey blow hot about dis match, and Joshua bin tok say e no go mercy for Paul as e tell am for one pre-match event say "if I fit kill you (for inside di ring), I go kill you".

On Thursday, during dia weigh-in event, Joshua tok say: "I go just outclass dis kid. I be serious fighter. Dat na di difference. I be serious, serious fighter."

Paul for im side bin don tell tori pipo say: "I dey ready. I want im hardest punches. I no wan make any excuses dey afta evritin don pass. Make we kill each oda."

Also afta di weigh-in on Thursday, Paul say im bin see fear for Joshua eyes.

"Di pressure dey on am. I dey fight free. I don already win. Dis na lose-lose situation for am. I don get am right wia I want am."

Dis no be di first time Anthony Joshua go fight somebodi wey no too be im level for professional boxing.

For march 2024, Joshua bin face Francis Ngannou, who bin dey try im luck for pro-boxing afta e don dominate di world of heavyweight Mix-Martial Arts.

Di match end for second round knockout victory for Joshua.

Wia dis match go happun

Dis ogbonge fight go hold for di Kaseya Center for Miami, USA, wey im former name na di American Airlines Arena and also FTX Arena.

Di 19,500-capacity arena na di home of di ogbonge basketball team Miami Heats.

Even though di venue na majorly a basketball event centre, dem fit also reconfigure am for concerts, worship events, family events, musical shows and oda stage productions.

Dis venue don bring goodluck bifor for Nigerian mix-martial arts fighter Israel Adesanya in 2023.

Na for dia Adesanya bin win im ogbonge revenge match against Alex Pereira for di UFC Middleweight Championship, wia e knock am out for di second-round.

Major World Wrestling Entertainment (WWE) fights don also happen for di Kaseya centre, but dis Anthony Joshua vs Jake Paul battle na di biggest event wey go happun dia so far.

Wen di fight go be and how you fit watch am

Di fight go take place dis Friday, 19 December 2025, and e go be eight rounds of three minutes for each round.

E go dey streamed live on Netflix so anybodi wey get Netflix subscrition go fit watch am as e dey happun.

Who be Jake Paul?

Jake Paul come for Cleveland, Ohio for USA and e be popular social media pesin wey bin gada billions of views for im videos wey e bin dey post on top 'Vine' betwin 2013 and 2017 bifor di platform close.

E come start to dey post videos on top YouTube for 2014, filming plenty prank and music videos wit im brother and fellow YouTuber, Logan.

In 2018, Paul come second for di Forbes list of YouTubers wey dey collect money pass, sake of combination of im streaming and video moni plus im oda business dem.

Na for day same 2018 e make im debut for boxing against anoda YouTuber Deji Olatunji. Paul win dat fight by technical knockout.

By 2020, Paul don go professional and im first fights as a pro na against YouTuber AnEsonGib and basketball player Nate Robinson, wit Paul winning di two fights.

From den, Paul bin don fight some professional Mixed Martial Arts (MMA) fighters and professional boxers - including di controversial match against 58-year-old Mike Tyson in 2024.

For June dis year, Forbes put Paul name as one of content creators wey dey collect di highest moni for di world as im money bin reach $50m for 2024.

Jake Paul boxing record

Paul don get 12 wins for 13 matches; im only loss na against Tommy Fury.

Im full record na:

30 January 2020: Ali Al-Fakhri - e win by technical knockout

28 November 2020: Nate Robinson - e win by knockout

17 April 2021: Ben Askren - e win by technical knockout

29 August 2021: Tyron Woodley - e win by split decision

18 December 2021: Tyron Woodley - e win by knockout

29 October 2022: Anderson Silva - e win by unanimous decision

26 February 2023: Tommy Fury - e lose by split decision

5 August 2023: Nate Diaz - e win by unanimous decision

15 December 2023: Andre August - e win by knockout

2 March 2024: Ryan Bourland - e win by technical knockout

20 July 2024: Mike Perry - e win by technical knockout

15 November 2024: Mike Tyson - e win by unanimous decision

28 June 2025: Julio Cesar Chavez Jr. - e win by unanimous decision



AJ bin knockout Francis Ngannou, UFC heavyweight champion wey bin wan try im luck for pro boxing, for March 2024

Source: BBC