Menu

Arise TV announce death of News anchor Somtochukwu Maduagwu

Somto.png Somto die afta armed robbers invade her house for Nigeria capital, Abuja.

Mon, 29 Sep 2025 Source: BBC

Somtochukwu Christelle Maduagwu wey be News anchor one of Nigeria media organisation Arise News, di news agency announce.

Somto die afta armed robbers invade her house for Nigeria capital, Abuja.

Di 29-year-old reporter and producer pass away on Monday 29 September, 2025.

According to Arise News Channel for dia statement wey Hadiza Usman-Ajayi sign, dem say police still dey investigate di armed robbery incident.

"Somtochukwu Christelle Maduagwu tragically pass away for di early hours of Monday, September 29, 2025 following armed robbery incident for her residence for Katampe area of Abuja wey dem currently dey investigate by di Nigeria Police," di statement say.

Sommie as dem dey popularly call her, na also lawyer aside her job as news anchor.

Arise News tok for dia statement say, she no be just "cherished member of di Arise News family but also vibrant voice wey dey engage and connect wit viewers."

"Beyond di airwaves, Sommie na lawyer wey be professional and supportive colleague and friend to many."

Di media organisation send dia condolence message to di family of di deceased while dem say dem still in shock as to di incident wey kpai Sommie.

Dem call of di police to do fast investigation, make dem catch and prosecute di culprits wey dey behind di robbery incident.

Dis dey come days afta Nigerian Bar Association (NBA) bin call on di federal govment to rescue one of dia members wey gunmen kidnap on her way from di recent Call to Bar Ceremony for Abuja, di kontri capital.

Tori be say gunmen kidnap Onyesom Peace Udoka wey dem newly call to Bar and her sister around di Lokoja–Okene axis for Kogi State, north central Nigeria.

Di president of di Association Afam Osigwe for statement on X say di development dey unacceptable and utterly condemnable.

"E dey heartbreaking say for time wen our nation suppose dey celebrate di future of di legal profession, young lawyers and dia families dey subjected to such harrowing ordeals.

Although di two incident no be di same and dem no dey related, but dis don raise kwesion of safety for Nigeria.

Source: BBC