Menu

Authorties launch investigation into death of 'Pooley' afta dem stab am during match violence

YF.png Francis Yaw Frimpong, alias Pooley, na popular and ogbonge fan of Asante Kotoko FC

Tue, 4 Feb 2025 Source: BBC

One fan of ogbonge football club for Ghana – Asante Kotoko don die afta dem stab am for one match against Nsoatreman FC.

Francis Yaw Frimpong, wia many pipo sabi as 'Pooley' die afta kasala wit anoda pesin during di game according to one statement from di home team Nsoatreman.

"Dis death wey happun na sad tin," di club Asante Kotoko tok.

Violence for football games don dey happun for Ghana for many years. In 2001, one kasala like dat don happun for di kontri capital Accra, wia cause di death of at least 120 pipo.

Dis Sunday match wey dem play for di central town of Nsoatre also bin scatter by fan violence as pipo dey throw objects on top di pitch.

Tins change wen some fans storm di pitch wia dem attack players and oda officials.

Asante Kotoko tok say "pitch invaders" don attack dia goalkeeper, Mohammed Camara, during di chaos.

Di match bin kontinu afta di drama wia Asante Kotoko lose di game 1-0 to Nsoatreman.

Both teams, Asante Kotoko and Nsoatreman, don condemn di kasala.

"Di game of football neva be war," di statement from Nsoatreman tok.

Pipo bin dey write tributes on top social media as im name don dey trend on top di X app for Ghana.

Francis Yaw Frimpong na passionate Asante Kotoko fan wia im don dey tok about di team for radio and TV.

Di Ghana football association don ban Nsoatreman from using dia home venue – di Nana Koramansah Park, until further notice as dem begin investigation into di mata.

Also, di GFA don postpone di next round of league games.

"Di GFA don dey work to improve di overall football experience for Ghana na so e dey important to deal wit dis kind tin wey happun to show say dis tin no dey acceptable for Ghana football," di association bin tok on Monday.

Authorities don open investigation into di death of oga Francis Yaw Frimpong.

Pipo don call for proper security for match venues across di kontri for di league wia don lose appeal for di last few years.

Despite say in di past dem bin punish teams to improve safety, violence kontinu to dey happun.

In 2022 di GFA bin fine Nsoatreman and Accra Young Wise afta dem no respect di safety rules for di game, wia dem ban Skyy FC say make dem no use dia home venue for seven games.



Di game don dey go on normally bifor fans enta di pitch to attack some of di players and officials

Source: BBC