Menu

Bomb blast inside mosque for Maiduguri kill at least five pipo on Christmas eve

Ujhgbm,b.png Dem carry di pipo wey injure go hospital

Thu, 25 Dec 2025 Source: BBC

Authorities say at least five pipo don die for one bomb explosion hours before Christmas, inside one mosque wey full for Nigeria north-eastern Borno state.

Reports for local media say anoda 35 pipo injured for di blast for di Gamboru market of Maiduguri, di state capital, during evening prayers.

Channels report say di incident hapun around 6:10 p.m. on Wednesday, as Muslim worshippers bin dey observe di Maghrib prayer.

Police Public Relations Officer for di state, ASP Nahum Daso, say preliminary investigations show say five persons don dey confirmed dead so far, while about 35 others injure.

Video for social media wey never dey verified be like e show after di explosion, wit pipo wey stand for di market area wit dust particles for di air.

No group don admit say na dem carry out di attack, but militants before don target mosques and crowded places for di area with suicide attacks and improvised explosive devices (IED).

Maiduguri dey di middle of di insurgency by di militant Islamist group Boko Haram and di Islamic State West Africa Province.

Military operations by Boko Haram to create Islamic caliphate for Borno state start for 2009.

Security measures against di group don fail to prevent sporadic attacks against civilians for north-east Nigeria.



Source: BBC