BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Borno state goment and UNDP handover resettlement community wey dem rebuild

85704495 President Muhammadu Buhari chief of staff, Ibrahim Gambari commission di 804 resettlement buildings

Sun, 23 Oct 2022 Source: BBC

Borno state goment and UNDP Nigeria handover community wey dem rebuild Borno state goment in collabo wit United Nations Development Programme for Nigeria, don officially open 804 houses wey dem build to resettle pipo of Ngarannam community. President Muhammadu Buhari chief of staff, Ibrahim Gambari, na im commission di resettlement for di IDPs on Saturday 22 October. Out of di 804 houses, di governor for statement say na 564 dem don complete for now. Zulum say goment dey build 304 houses while di UNDP dey build 500. Govnor Babagana Zulum handover di 360 houses to di community, including marketplace and school, house for teachers and security forces plus one police station. Di house owners also gifts of 2.674 cows, cloths, food amd N100 for each house owner. Di EU bin also participate for di project through im support to di Regional Stabilisation Facility. For July 2019, UNDP bin develop di di Regional Stabilisation Facility  wit di support Sweden, di Netherlands, Germany, di United Kingdom and European Union.

The reopening of #Ngarannam today was proof of how #Stabilization is restoring hope and dignity for communities when done in collaboration. Thanks to @BornoGov, the Fed. Govt of ???????? and our partners ????????????????????????????????????????for making this possible for the people of #Ngarannam#StabiliseNigeria pic.twitter.com/Ts4HrTD8Ec— UNDP Nigeria (@UNDPNigeria) October 22, 2022

Borno: @MBuhari’s CoS Gambari opens 804 houses built by @UNDPNigeria, @ProfZulum’s Govt … House-owners gifted 2,674 cattle, 100k each, food, clothes https://t.co/2mTaYGClAO pic.twitter.com/Lp8Uz33wld— Governor Borno (@GovBorno) October 22, 2022

After months of rebuilding, #Ngarannam community has officially been opened w/ Governor of #BornoState @ProfZulum handing over 360 houses to the community, a marketplace, a school, housing for teachers & security forces & a police station. pic.twitter.com/IBqcPu3whI— EU in Nigeria ???????????????? (@EUinNigeria) October 23, 2022 Plenty communities for di state dey displaced for years now sake of di Boko Haram insurgency. Di jihadists attack and destroy Ngarannam community for Mafa, some years back. Most dis internally displaced pipo dey don dey live for IDP camps for years, but bin dey worry to go back home to dia communities. But dis request bin dey difficult for goment to fulfil becos in addition to security issues, di insurgents bin burn many communities to ashes, so di pipo no get anytin to go back to.

Source: BBC