ELECAM don establish one National Commission for di final vote count of di presidential election
Cameroon Electoral Council (Elecam) don establish one National Commission for di final vote count of di presidential election wey hold on 12 October.
Di Chairman of di Electoral Council, Dr. Enow Egbe wey announce di informate on Thursday, 16 October, say di commission go dey responsible for examining and validating all di regional votes tally bifor di official declaration of di results.
Dis one mark di final phase of di presidential election process.
Di electoral chair add say dem go centralise di results and send di national tallies to di Constitutional Council, wey get until 26 October to announce official results.
Di commission also dey expected to hold meeting dis Friday to solve any electoral disputes bifor di final declaration of di results of di presidential election.
Who dey di National Commission for di Final Vote Counting
According to di resolution wey di chairman of di electoral commission sign, di National Commission for Final Counting include judicial magistrates, representatives of di administration, representatives of di Cameroon Elections and representatives of di 12 candidates for the October 12, 2025.
.Chairperson: Essombe Emile
.Members
Representatives of di judiciary
.Fonkwe Joseph Fongang
.Ondoua Obounou Charles
Representatives of di administration
.Nganko Firmin Daniel
.Litet Gabriel Francois
.Bekila Gisele Valerie
.Oumarou Chinmoun
.Issanda Issanda Solomon
Representatives of Elections Cameroon
.Abdoulkarimou
.Enow Dickson Enow
.Amugu Abena Agathe Gaelle
.Nnomo Millang Christelle Leopoldine
Representatives of Candidates
.Ateki Seta Caxton
.Pierre Flambeau Ngayap
.Bougha Jacquees
.Issa (FSNC)
.Dennis Antagana
.Kwemo Pierre
.Nyeck Felix
.Bonono Rene
.Muna Tabeng
.Osih Nambangi
.Tomaino Njoya
Ova eight million registered voters bin take part for di election to choose a new leader from among di ten candidates wey dey eye di number one job – among dem na di incumbent President Paul Biya wey don dey for power for ova forty years.
Di presidential election bin come for di middle of inflation, youth unemployment, security challenges, corruption, and poor social services.
Among Biya challengers for di race na two of im former northern allies, Issa Tchiroma Bakary and Bello Bouba Maigari. Dem don criticise di president style of governance and dem promise to bring change.
Several voters tok say dem hope say di next president go bring change to di kontri wey get many problems, wey include poor social services.