Menu

Child sex abuse victim beg Elon Musk make e remove links to her images

Screenshot 2025 08 26 110618.png One victim of child sexual abuse don beg Elon Musk to stop links wey dey offer images

Tue, 26 Aug 2025 Source: BBC

One victim of child sexual abuse don beg Elon Musk to stop links wey dey offer images of her abuse wey pipo dey post on im social media platform X.

"To hear say my abuse - and di abuse of so many odas - still dey circulate and dey commodified here dey vex me," "Zora" (no be her real name) wey dey live for United States, tok. Dem first abuse am more dan 20 years ago.

"Evri time pesin sell or share child abuse material, dem dey directly fuel di original, horrific abuse."

X say dem get "zero tolerance for child sexual abuse material" and add say to dey tackle pipo wey exploit children na "top priority".

Di BBC bin find images of Zora while investigating di global trade of child sex abuse material, wey dey estimated to worth billions of dollars by Childlight, di Global Child Safety Institute.

Di material dey among cache of thousands of similar photos and videos wey pipo dey offer for sale on X account. We bin get in touch wit di trader through di messaging app Telegram, and dis lead us to one bank account wey dey linked to one pesin for Jakarta, Indonesia.

Na one family member first abuse Zora. A collection of images of her abuse don dey popular among paedophiles wey dey collect and trade such content. Many oda victims dey face di same situation, as images of abuse continue to circulate today.

Zora dey vex say di trade dey continue to dis day.

"My body no be commodity. E neva be commodity, and e no go eva be" she tok.

"Dose wey dey distribute dis material no be passive bystanders, dem be complicit perpetrators."

Tracking di X account

Images of Zora abuse bin dey originally only available on di so-called dark web, but she now dey live wit di reality say pipo dey openly promote links on X.

Social media platforms dey try get rid of illegal materials, but di scale of di problem too big.

Last year di US National Center for Missing and Exploited Children (NCMEC), bin receive more dan 20 million mandatory reports from tech companies about incidents of child sexual abuse material (CSAM) - illegal images and videos on their platforms.

NCMEC bin attempt to identify victims and perpetrators, di organisation den contact law enforcement.

We bin approached "hacktivist" group Anonymous, wey dia members dey try combat di trade in child abuse images on X. One of them tell us say di situation dey bad as bifor.

Dem tell us about one single account on X. Di account use foto of di head and shoulders of real child as im avatar. Notin dey obscene about am.

But di words and emojis for di account bio make am clear say di owner dey sell child sexual abuse material and link dey to one account on di messaging app Telegram.

E appear say di trader base for Indonesia and dey offer "VIP packages", collections of images and video files of abuse for sale to paedophiles around di world.

Di Anonymous activist don dey work to report di trader multiple accounts on X, so dem fit dey removed by di platform moderation systems. But each time one account dey removed, anoda one go replace am, e tell us.

Di trader appear to don oversee more dan 100 almost-identical accounts. Di activist tell us say wen e bin contact di trader directly using Telegram, di trader bin reply say e get thousands of videos and images for sale.

"I get baby. Kids young 7-12", he write for messages to di activist wey BBC take eye see. E also explain say some of di content show child rape.

We bin get in touch wit di trader oursefs.

E bin provide links to samples of material, wey we no open or view. Instead, we contact experts from di Canadian Centre for Child Protection (CCCP) for Winnipeg - wey dey work alongside law enforcement and dey legally permitted to view such content.

Source: BBC