BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Cook-a-thon trend among Nigerian chefs and how you fit break world record

Chef Hilda Baci

Tue, 13 Jun 2023 Source: BBC

E be like say di Cook-a-thon tori wey dey trend for Nigeria since May no go end soon.

Dis na sake of how Nigerian chefs don begin turn am to challenge.

Afta one popular Nigerian chef Hilda Effiong Bassey, wey pipo dey call, Hilda Baci, don attempt to break record for di longest cooking marathon by individual, oda chefs for Nigeria don draw inspiration from di idea.

Cook-a-thon now don dey turn to trend among Nigerian chefs.

Dem dey hope to break di Guiness World Record.

Hilda Baci become popular and capture di heart of her nation afta she cook for more dan 100 hours non stop.

She bin attempt to break Guinness world record.

Although di Guinness World Record team never confam Hilda Baci attempt.

Source: BBC