BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Court clear ex-Man City footballer Benjamin Mendy of rape charges

15864529 Di French international bin dey under contract to Manchester City until 1 July

Fri, 14 Jul 2023 Source: BBC

One jury don clear former Manchester City footballer, Benjamin Mendy of di accuse say e rape one woman and make attempt to rape anoda one.

Dem accuse di 28-year-old say e attack one 24-year-old woman for im £4m mansion for Mottram St Andrew, Cheshire for October 2020.

Dem also accuse Mendy of di attempted rape of anoda woman wey be 29 years. Di woman bin claim say e molest her for im house two years before di first woman own.

E dey come afta one court clear am of six rape charges for one trial wey bin hold for January.

Di France international begin cry as di jury foreman begin read out di not guilty verdicts, afta a three-week trial for Chester Crown Court.

Di jury of six men and six women bin analyse di mata for about three hours and 15 minutes before dem reach dia conclusion.

Judge Steven Everett say: "Oga Mendy fit dey discharged from di dock."

Di footballer, wey im contract wit Manchester City bin expire earlier dis month, bin dey cleared for di earlier trial of six counts of rape and one count of sexual assault, wey relate to four young women or teenagers.

During di trial oga Mendy bin tok how e sleep wit more dan 10,000 women.

Source: BBC