Julius Malema bi di President of EFF and South Africa opposition leader
East London Magistrate Court don find di President of Economic Freedom Fighters and South Africa opposition leader Julius Malema guilty of discharging one firearm in public seven years ago.
For 2018, one video bin spread wey show how di Economic Freedom Fighters (EFF) leader fire several shots in di air during im party fifth anniversary celebrations wey hold for di kontri Eastern Cape province.
E dey charged alongside im former bodyguard Adriaan Snyman, wey court declare not guilty.
Dis na Malema second conviction in less dan two months and e fit face up to 15 years in prison.
Dem neva sentence am yet.
Wetin be di charges?
Di charges against di South African firebrand politician Julius Malema include:
.Discharging a firearm for public place
.Unlawful possession of firearm
.Unlawful possession of ammunition
.Failure to take reasonable precautions to avoid danger to pipo or property
.Reckless endangerment of a pesin or property
Di first charge carry maximum 15-year sentence.
E chop accuse say e fire between 14 and 15 live rounds on top stage in front of 20,000 EFF supporters, according to South African news site SowetanLIVE.
For im defence, Malema tell di court say no be im get di gun im bin fire di shots to ginger di crowd, di publication add.
E take three days for magistrate Twanet Olivier to tell Malema "you dey found guilty as charged".
Di magistrate don postpone di case to January 2026 for pre-sentencing.
Malema prosecution come afta di Afrikaner lobby group AfriForum, one group wey get gbege wit Malema and di EFF, open case against am afta di video bin go viral.
AfriForum bin also dey among dos wey lay hate speech complaint against di EFF MP for South Africa Human Rights Commission.
Dis one make South Africa equality court find am guilty for August dis year.
Afta one incident wia one white man allegedly assault one EFF member, Malema say: "No white man go beat me up... you must neva dey afraid to kill. Revolution demand say at some point, killing must hapun."
Di equality court bin rule say dis comments "demonstrate intent to incite harm", but di EFF, say dem take dem out of context.