BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Court go gree put Ipob leader Nnamdi Kanu under house arrest?

Screenshot 2024 05 20 111811.png Nnamdi kanu, leader of di secessionist Indigenous People of Biafra (Ipob)

Mon, 20 May 2024 Source: BBC

Di matter between Nnamdi kanu, leader of di secessionist Indigenous People of Biafra (Ipob) and di Federal goment go kontinu on Monday for di Federal High Court, Abuja.

Di case go begin by 12:00 (Nigerian time) bifor Justice Binta Nyako who don dey in charge of di matter since goment first arraign Kanu in 2015.

Kanu dey face eight-count charge wey border on terrorism and belonging to a proscribed organisation bicos of im fight make di south-eastern part of Nigeria pull away to become dia own kontri wey im name go be Biafra.

E dey important to note say since di Nigeria goment reaarest Kanu for Kenya in June 2021, im trial neva actually resume sake of di many complaints wey im lawyers dey make against di Department of State Services (DSS) wia Kanu currently dey detained.

Aloy Ejimakor, wey dey usually tok on behalf of Kanu, dey allege say im client neva dey ready for trial bicos di DSS no dey allow am and im oda lawyers to get "unhindered access".

On di last adjourned date...

For di last hearing day in April, Ejimakor bin tell Justice Binta Nyako say dia visit to Kanu for di DSS cell na just for 30 minutes per counsel, and di DSS pipo no dey gree for two lawyers to see him at a time, dem no dey fit enta wit any writing materials to take notes, and dia conversations dey monitored all di time.

"We dey apply make our client dey transferred to home detention or house arrest," Ejimakor bin beg di court dat day.

Di defence counsel make dis plea after Justice Nyako bin don refuse several times to transfer Kanu from DSS custody to Kuje correctional facility, as she tok say she no get confidence in di security of di facility.

E dey expected say Justice Nyako go rule on di application on whether to grant Kanu di house arrest wey im apply for.

Also, di federal goment dey expected to call dia first witness, wey go signify say trial don actually begin.

Justice Nyako bin threaten say if Kanu and im team neva dey ready for trial, she no go get any oda choice dan to adjourn di case "sine die", until wen dem don ready.

Source: BBC