Menu

Court remand Queen Naomi and Oriyomi Hamzat for prison

Queen Naomi Silekunola Photo collage of Queen Naomi and Justice Olabisi Ogunkanmi

Tue, 24 Dec 2024 Source: BBC

Justice Olabisi Ogunkanmi of di Iyaganku Magistrate Court in Ibadan, Oyo State, don order di remand of former Ile-Ife queen, Naomi Silekunola, and Oriyomi Hamzat, wey be senior manager of one radio station in Ibadan, for custody.

Di judge wey also order di oga of one Islamic High School for Bashorun, Ibadan, too make im too dey remand.

Na for Agodi Prison in Oyo State dem go dey until dem hear dia cases again.

Di believe be say na dis three pipo get hand for for di recent stampede for Ibadan, wia no fewer dan thirty-five children suddenly die.

Na queen Naomi bin organise di annual food distribution program for no less dan five thousand children in Ibadan, wit di aim to make dis Christmas a happy one for dem.

According to tori, na four counts of aggravated assault police sama di suspects, offence wey dey against Section 324 of di 2000 Penal Code.

Justice Ogunkanmi order make di three dey remanded in custody until dey receive advice from di Director of Public Prosecutions.

Na at least 35 children die and many more wunjure, for one event wey di former queen of Ooni of Ile-Ife, Naomi Ogunwusi organise for Ibadan.

Those wey attend di event bin tell BBC say e neva tey wen di program start wen di stampede shele.

Dis no be di first time wey di Naomi Silekunola Ogunwusi go host dat kain event.

Na evri year she dey run di programme under her charitable organization, Women in Need of Guidance and Support (WINGS).

Di Oyo State Police Command on Thursday 19 December gbab Olori Naomi Ogunwusi and odas sake of di tragedy.

For statement wey dem release, di police tok say na 35 pipo bin die for di stampede.

"So far thirty-five minors don dey documented to don die while six odas dey critically injured and on various medical interventions," di statement tok.

Apart from di ex-Queen wey be di main sponsor of di event, seven odas including di school principal also dey police custody.

Di police say dem don transfer di case to di Homicide Section of di State Criminal Investigation Department, Iyaganku and add say na di Deputy Commissioner of Police in charge dey lead di investigations.

How di crush take happun?

Oga Musiliu wife wey too dey down to tok explain to her husband say di crowd too plenty and many pipo bin dey locked out.

She say dose wey arrive early bin dey allowed to enta while larger group wey later arrive bin dey locked outside.

"Wen di founder of Agidigbo FM, Oriyomi Hamzat, finally arrive for di venue, di security open di gate. For dat moment, di waiting crowd seize di opportunity to force dia way through di narrow entrance, wey lead to di stampede," Mr Musiliu quote im wife.

Mrs Salawu also say na crowd wey rush inside wen Hamzat enta cause di stampede.

"We don dey gate since 5:00am. If to say dem open gate wen we arrive, wetin happun for no happun, no pikin for die.

"Na bifor 6am Oriyomi arrive. Di gateman no wan give Oriyomi key, Oriyomi snatch di key from am and open di gate. Na wen e open di gate pipo rush inside and begin fall ontop each oda. Oriyomi kon begin help dem. By di time I see my pikin, dem don crush am, e don shit, di pikin don die," she tok.

Although Mr Musiliu don find solace for im faith and "accept wetin happun as di will of Allah", e appeal to organisers of such event to take steps to prevent such tragedies for future.

Source: BBC