Menu

D'Tigress collect national honours, $100,000 each for wining AfroBasket

A Tinubu.png Nigeria president Bola Tinubu don give di women national basketball team members national honours

Tue, 5 Aug 2025 Source: BBC

Nigeria president Bola Tinubu give di women national basketball team national honours and cash gift for wining di 2025 Women's Afrobasket for Ivory Coast.

President Tinubu promise to give each player $100,000 and an additional $50,000 to members of di technical crew.

Nigeria beat Mali 78-64 to win dia fifth straight title and seventh overall

Vice President Kashim Shettima, wey represent Tinubu for di event, announce di rewards as im receiving D'Tigress for di presidential villa on Monday.

Each player and official for di team go also get one flat for Federal Capital Territory (FCT).

Nigeria beat Mali 78-64 to win dia fifth straight title and seventh overall.

Di victory mean say Nigeria na di only kontri to win the women's AfroBasket title five times in a row.

Wakama influence

Di glue wey dey hold dis team togeda na Rena Wakama, dia 33-year-old coach wey her journey wit di team dey remarkable.

Since she take charge as di first female head coach of D'Tigress, Wakama now don win di AfroBasket twice.

"I believe say her ginger, her drive to make name and also prove point to her critics wey bin no feel say she bin dey good enough to take di job na why we dey see dis impact," basketball commentator and analyst Queen John-Moseph bin tell BBC Sport Africa last year.

Udoka, wey bin serve as assistant coach wit D'Tigress, say di job wey Wakama dey do dey "amazing".

"E good for her on to say she dey young and e show di bright future wey she get," di former international add.

Wakama hope say her journey go inspire pipo across di continent to go pursue dia dreams and, most importantly, help grow di women game.

D'Tigress don also qualify for di 2026 Fiba Women World Cup for Berlin, Germany.

Dia victory dey come one week afta Nigeria women national football team victory at di recent Women's Africa Cup of Nations (Wafcon) for Morocco.

Source: BBC