Di Anambra State Police Command don confam on Sunday say 22 people die for di rice stampede wey shele occur on Saturday for di Ihiala local goment area of di state.
Dis latest figure dey come afta di Tochukwu Ikenga wey be di tok-tok pesin for di state police command bin tell BBC News Pidgin on Saturday say na three pipo death dem bin record for di stampede as at di time of filing our first report on di tori.
Di Anambra State goment also express grief over di tragic loss of lives for di incident.
Di Commissioner of Police for Anambra State, CP Nnaghe Obono Itam, bin provide di latest figure afta im visit di hospital wia di victims of di stampede dey receive treatment.
Ikenga wey speak on behalf of di CP say for one statement say investigation into di unfortunate incident dey go on.
E assure say di police command remain dedicated to ensuring the safety and well-being of di pipo of Anambra through crime prevention, prompt and effective emergency response, protection of vulnerable population, and foster a sense of security and community.
Di incident happun on di same day stampede happun kill at least 10 pipo, including children for di Holy Trinity Catholic Church for Maitama, Abuja,
Both incidents happun three days afta stampede kill 35 children for one funfair for Ibadan, di Oyo State capital.
Di CP assure say di police command remain dedicated to ensure di safety and well-being of di pipo of Anambra through crime prevention, prompt and effective emergency response, protection of vulnerable population, and foster a sense of security and community.
Govnor Charles Soludo tell victims families sorry
Meanwhile, di Anambra State Govnor Charles Soludo don tok sorry to di families of di pipo wey die, most especially di women, elderly pipo, pregnant women, nursing mothers and children wey die for dis unfortunate mata.
Di govnor tok sorry inside statement wey im tok-tok pesin Christian Aburime issue.
Di statement tok say, according to information wey dey outside, di state goment tok say true-true na di Obi Jackson Foundation wey dey led by Chief Ernest Obiejesi na dem organise di event to share relief materials give less privileged members for dis festive period.
According to di govnor, wetin di tragedy show na di urgent need to arrange more structured and safer approach to take do dat kain distribution.
E tok say, "Di Anambra State goment don ansa di mata by say dem start ogbonge investigation into di mata wey cause di stampede. Di goment go work closely wit relevant agencies to determine di root cause of dis sad mata and make sure say lapses for safety protocol dey addressed".
Meanwhile goment don tell all well-meaning pipo and joinbodis wey wan do charity make dem make safety and well-being of dia beneficiaries to be di most important tins.
Soludo don strongly advise say make future charity distributions dey more organised wit beta crowd control for ground.
E add say, "Dis method fit include to get plenti distribution points for inside di community so dat overcrowding no go dey one location, to get system wey go prioritise pipo like di elderly, women wit belle, pikin dem and pipo wey get disabilities, to get trained pipo wey go manage crowds, ensure beta queue and give assistance for pipo in need and to do public awareness campaign to educate di public on how to dey safe for dat kain events."
Vice President Shettima mourn victims
Vice President Kashim Shettima don mourn di victims of di recent tragic stampedes wey claim lives for Anambra, Abuja and Ibadan.
Shettima for one statement on Sunday by im tok-tok pesin Stanley Nkwocha, highlight di urgent need for improved safety measures during public gatherings.
For im condolence message, e express deep sorrow ova di losses, just as e offer prayers and condolences.
"I dey extremely saddened by dis tragic incidents wey don claim innocent lives. My prayers and thoughts dey wit di grieving families of all victims, including dose wey sustain injuries and dey undergo treatment," e tok.
"I dey particularly veri worried and upset by di fact say so many lives of Nigerians, particularly children, don dey lost in stampedes wey suppose dey avoided through proper planning and organisation.
"Dis no be just a loss for individual states; na loss for di entire nation. May di Almighty God grant eternal rest to di souls of di departed," di VP tok.
Shettima assure di families say di federal goment go provide necessary support during dis difficult period.
"We stand ready to support di bereaved families through dis difficult period, and no effort go dey spared in providing di necessary assistance dem need.
"We don direct relevant agencies to provide immediate support to affected families. To dose wey currently dey receive treatment for various hospitals, dia recovery na our priority, and we go stand wit dem through dis challenging time," e tok.