SP Tochukwu Ikenga (L) bi di tok tok pesin of Anambra State Police Command
Di police for Anambra State, southeastern Nigeria, say dem don gbab one suspect wey dey connected to di murder of one pregnant nurse wey dem cut and pieces her bodi.
Police say dem recover human parts from one native doctor shrine wey dey linked to di incident and dem still dey find oda suspects wey get hand for di murder.
Dis incident hapun for Ogbunike, Oyi local govment area of Anambra State.
According to di tok tok pesin of Anambra State Police Command, SP Tochukwu Ikenga, e say dem arrest one 24 years old woman on 25 July 2025.
Dem say she be one of di suspects, wey dem say allegedly dey in connection for di murder of di pregnant nurse.
"Di Anambra State Police Command wit di help of di Umueri village, Ogbunike community members bin arrest one female suspect, 24 years.
Di arrest dey in connection wit di horrible murder of one pregnant nurse, wey we find her pieces bodi for one soakaway pit for Ogbunike, Oyi local govment area of Anambra State." E tok.
According to di police, di suspects bin don alreadi cut di bodi of di pregnant woman into pieces, bifor dem find am for soakaway pit.
'Dem dey sell body parts to native doctors' - Victim tok
Di police say dem discover new informate from questions wey di suspect answer during investigation.
According to di police, di lady wey dem arrest 'confess' say she be girlfriend to di pesin wey really kill di pregnant nurse, but dem call her to come clean di bodi.
Police say she also tell dem say dem dey also sell body parts to native doctors for di area.
"During interrogation, di suspect confess say she be di girlfriend of di prime suspect from di same village, wey currently dey on di run.
She say di suspect call her to come clean di blood stains afta dem murder di victim. She also reveal how dem dey sell di body parts to different evil native doctors for di area."
Base on information, na di suspect bin invite di pregnant nurse to im house wit lie say e dey sick and need medication. Na wen di nurse bin reach di house, di incident hapun wey lead to how she kpai.
Police burst shrine, find human parts for nylon
As part of dia investigation, di Anambra Police Command say dem burst one shrine for di village wia dem find human body parts.
Dis State Criminal Investigation Department (SCID) for 29 July 2025 bin find human body parts for inside nylon inside di shrine.
"Sake of di information from di suspect, SCID burst one shrine of one native doctor, from Itima Amawa Village, Ogbunike and recover suspected human body parts, wey dem hide for cellophane (nylon) bags.
Di command dey find di prime suspect, along wit di suspected receivers and collaborators."
Meanwhile, di Police Commissioner for Anambra State CP Ikioye Orutugu don condemn di act.
E describe di act as "criminal", wia e ask anyone wey get information of di suspects to come report dem.
Police promise say dem go protect any informant wey give details of wia dem fit find di suspects wey dey involved for di killing of di pregnant nurse for Anambra state.