Puerto Rican star Daddy Yankee wey sing Despacito
Puerto Rican star Daddy Yankee wey sing Despacito don tok say im dey leave music to carry im cross follow Jesus.
Di star wey bin also drop di song Gasolina reveal dis informate for im last show for im La Última Vuelta (Last Lap) world tour.
Di 46-year-old rapper bin reveal say, "living a successful life no be di same tin as to live life wey get purpose. For long, I don try to fill di empitness wey nobody fit fill.
"Na why tonight I recognise say I no dey shame to tell di world say Jesus dey live in me and I go live for am."
Dis na ogbonge about turn for one of di ogbonge voices for reggaeton, di sexuallly charged, street- smart style wey show for Panama and Puerto Rico for di 1990s, wey mix reggae music with Latin America dancehall music and hip-hop.
Daddy Yankee wey im family name am Ramón Luis Ayala Rodríguez na one of di biggest stars from dis kain music.
E drop im first solo record for 1995 and don go on to collabo with pipo like Justin Bieber, Snoop Dogg, Janet Jackson and di Jonas Brothers.
E bin announce say e go bow out for March as im drop im first album in ten years wey im call Legendaddy and di promise say im go do im biggest show.
As im finish im last show for San Juam, di star thank fans, for dia support as im tell dem say "follow Jesus Christ wey be di way, di truth and di life", as drones fly ova di stadium form cross for air.
E no go be di only one for di raggaeton community wey go drop music for religion, even last year, Puerto Rican rapper Farruko tell fans sorry for Miami for di bad language wey full im songs as im follow dem tok about religion.
But no be only reggae music. See oda stars wey leave behind successful career to devote dia life to God.
But for May 2021, she announce why she dey leave secular music to turn gospel singer. She say she wan leave fame now and wan work for her papa.
Pastor Chris don also venture into politics. For 2003, e start a political campaign to become president of Nigeria but e no win.
For 1997, im first album, Harlem World bin dey top charts but wen im second album no gree blow, im tell New York DJ Funkmaster Flex for interview say e don find God and dey comot rap so im no go "lead pipo, friends, and pikin dem to di road to hell".
E don change back to di name dem born am with wey be Mason Durell Betha and be pastor wey get church for Atlanta.