Menu

Di most expensive cities and least expensive for expatriates in 2024

Screenshot 2024 06 20 155451.png Abuja, na one of di major cities in Nigeria wit about three million pipo

Wed, 19 Jun 2024 Source: BBC

Di capital of Nigeria for West Africa , Abuja, dey among di world's least expensive city for foreign workers.

Abuja, na one of di major cities in Nigeria wit about three million pipo, e dey among di cities dem chook eye for, inside one 2024 cost-of-living survey by consultancy firm Mercer.

Di annual report, rank two major cities, Abuja and Lagos at 225 and 226 respectively, among di least expensive cities for expatriates to live.

Di ranking na based on di cost of living like; housing, transport, household goods, entertainment and food.

Mercer tok say dem evaluate more dan 226 cities and ova 200 items for dia report,

Dis information go help foreign and local companies around di world.

According to Mercer, na Hong Kong, Singapore and Zurich be di costliest cities for foreign workers.

Dis three cities hold di same position for last year survey.

Di cost of housing na major factor for di Cost of Living City Ranking analysis. According to di report, "Between 2023 and 2024, cost of tins around di world increase, housing rental prices different between cities."

Most of di top 10 most expensive cities also increase, but some cities dey between 3% and 8% for all di cities except Nassau and Bahamas.

Also, shortage of housing dey push prices of items up for foreigners. Wen housing costs dey high, employees go need to spend more money on rent or mortgage, dis go further increase dia expenses. Dis fit lead to financial stress and reduce standard of living, wey fit get impact on employee.

Rising housing and food cost for many cities around di world don make am difficult for organizations to employ foreigners. As housing cost dey rise, organizations fit allocate dia budgets to provide competitive compensation packages wey go include housing allowances or subsidies.

10 most expensive cities for foreigners

Five European cities dey among di top 10 most expensive places for foreigners to live. Among di list, four Switzerland cities, rank between di third and sixth place.

Hong Kong take di top spot for di costliest cities for international workers to live in di world and across Asia kontris.

High inflation dey among di cause of di increase in prices for goods and services over time for di kontri.

Di high inflation don push many citizens of di kontri into poverty.

*Hong Kong

*Singapore

*Zurich,Switzerland

*Geneva,Switzerland

*Basel,Switzerland

* Switzerland

*New York City,United States

*London,United Kingdom

*Nassau, Bahamas

Los Angeles, United States

10 least expensive cities for foreigners

Three cities in African, dey among di least cost of living city ranking, according to Mercer.

Di most expensive cities for Africa na Bangui (14), Djibouti (18) and N'Djamena (21).

*Havana

*Windhoek

*Durban

*Dushanbe

*Blantyre

*Karachi

*Bishkek

*Islamabad

*Lagos

Source: BBC