Menu

Dolly Parton sister say make fans pray for Country Music veteran

Dolly Parton.png Dolly Parton sister don ask fans to pray for di ogbonge American country singer

Wed, 8 Oct 2025 Source: BBC

Dolly Parton sister don ask fans to pray for di ogbonge American country singer afta she postpone her Las Vegas residency sake of health mata wey she no gree tok outside.

Di 79 year old music legend don alreadi delay her December concerts as she tell fans say she need "few procedures" to handle "health wahala".

Di sister, Frieda Parton write for Facebook say, "Last night, I bin do all night prayer for my sister, Dolly. Most of una know say she no dey feel her best lately.

"I believe in di power of prayer wella and I dey led to ask all di world wey love am to turn prayer warriors and pray wit me".

Frieda end di message on high note as she write say, "she dey strong, she dey loved and wit all di prayers wey dem don pray for her, I know for my heart say she go well. Godspeed my sissy Dolly. We all love you".

Tok-tok pesin for Dolly Parton tell CBS wey be BBC US partner say she go post social media message on Wednesday wey go "tok about evribodi worry".

Parton suppose perform six shows for The Colosseum for Caesars Palace for December.

But she postpone am till September next year say she bin no get enof time to rehearse for dem.

Dis waka go Las Vegas suppose be her first to di Strip since di 1990s wen she bin perform togeda wit Kenny Rogers wey follow her sing di hit song Islands In The Stream.

Parton neva tok wetin dey do her but recently she even cancel Dollywood event afta dem find kidney stone for her wey she say bin dey cause "plenti wahala".

For March dis year, she bin loose her husband Carl Dean afta almost 60 years of marriage. She bin sing di song If You Hadn't Been There to remember am.

Who be Dolly Parton?

Dem born Dolly Parton for 1946 for one room cabin for Tennessee wit six brothers and five sisters. According to her dem bin grow up "dirt poor".

Wen she be small pikin she go dey imagine say di fowl for her hard be her fans.

She later turn child celeb as pikin bifor she record her first hit at di age of 13 and japa go Nashville di day afta she finish hight school.

She bin dey write songs give oda pipo as teenager but for 1966 she get her own hit wit di song Dumb Blond.

Na still for dat year she marry her husband Carl Deen. From 1967 she call her first few albums say dem specialize in "sad ass songs" den she drop feminist bop fir 1968 wey she call Just Because I'm a Woman.]

For di 70s howeva, her hand mature for song writing and na wen she start to drop bangers like Jolene wet don dey covered by many artists including her own god-daughter Miley Cyrus and di song I Will Always Love You wey Whitney Houston make popular.

By 1977, Dolly Parton don shift to pop superstart wen she make her first US platinum album, Here You Come Again.

For di 1980s she start to dey act and bin sing di Oscar nominate song 9 to 5 and Islands in the Stream.

For 1986, she don drop anoda banger wen she open di Dollywood theme park for Tennessee bifor she act for Steel Magnolias.

Even sef na ger company Sandollar Productions rin di series for Buffy the Vampire Slayer.

She don also make cameo appearances for plenti series, like di Disney show of her god daughter wey dem dey call Hannah Montana.

For November 2020,, e comot say Dolly Parton bin drop $1m for Morderna Covid-19 vaccine effort.

More recently she don run plenti big songs featuring trending musicians as for 2024, she follow Sabrina Carpenter do di remix for Please Please Please.

Source: BBC