BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Ekiti State don officially swear in Biodun Oyebanji as Governor

35027621 Biodun Abayomi Oyebanji

Mon, 17 Oct 2022 Source: BBC

Abiodun Oyebanji, don take im oath of office as di Ekiti State Governor. Na di Chief Judge of Ekiti State, Hon. Justice Oyewole Adeyeye swear am im at about 12: 53pm as pipo gada for di event on Sunday, October 16. Govnor Abiodun pledge to preserve, protect and defend plus preserve di office as di number one citizen of di state. “Today mark di beginning of a new dawn for Ekiti, and I dey more than proud to serve di good people of our dear state.”, e tok. Inec bin declare di APC candidate, winner of di Ekiti govnorship election wey happun on Saturday, 18, June, 2022. Biodun Oyebanji win 15 out of 16 local goment areas for di state. Wetin Oyebanji tok for inauguration? “As I assume di office today, na to actualise di prosperity of Ekiti pipo.” Govnor Oyebanji tok. E say im vision na for Ekiti State to become a land of prosperity, opportunity, peace and progress. “Di land wia transformed pipo and communities fit reap di fruits of dia labour in dignity, good health and safety. “Land of honour wia integrity mata.” Part of im promises na say im go make sure to give priority to gender mainstreaming and women empowerment for all policies and programs. E also say im go create employment and income-generating opportunities for di pipo of Ekiti, make sure say children fit access free and qualitative basic education up to Senior Secondary School 3 “Dis task go be di toughest of my life but e say wit di pipo on im side im go fit achieve am.”, e add am. Wetin to know about di new Ekiti State govnor Biodun Oyebanji Biodun Abayomi Oyebanji na public servant wey be 55 years old Oyebanji come from Ikogosi-Ekiti for Ekiti State. Im don serve as Special Assistant (Parliament Affairs) to di Governor of Ekiti State from 8th June 1999-2000 and August 1, 2000 to September 2001. Im also serve as Chief of Staff to Governor of Ekiti State between September 2001 to May 29, 2003. Oyebanji work as Commissioner, Ministry of Budget, Economic Planning and Service Delivery, Ekiti State from January 10, 2013 to October 16 2014, and also Secretary, Ekiti State Goment 16th October 2018 till December 7, 2021. Di Ekiti state born politician don tey for politics. E join public service for im 20's as di secretary to di committee wey dem set up for di creation of Ekiti state for 1994. Oyebanji na former university lecturer before e join politics. E bin serve as special assistant on legislative matters to di first governor of Ekiti State, Otunba Adeniyi Adebayo, before e later become im Chief of Staff. For di first term of di current governor, Kayode Fayemi, Oyebanji serve as di director-general, Office of Transformation, Strategy and Delivery; Commissioner of Integration and Inter-governmental Relations; and Fayemi later appoint am as Commissioner of Budget and Economic Planning. E don hold oda political offices for di state and e resign as di secretary to di state goment on December 7, 2021 to join di govnorship race. Dem born di APC governorship candidate for December 21, 1967. E get Bachelor of Science (BSc.) degree in Political Science from di Ondo State University (now Ekiti State University, Ado-Ekiti) for 1989. Masters' Degree in Political Science (International Relations & Strategic Studies) for di University of Ibadan. Oyebanji dey married to Prof. (Mrs) Oyebanji, wey be associate professor for di University of Ibadan. Di Govnors wey don lead Ekiti before now Otunba Niyi Adebayo na di first elected Civilian Governor for di state. Im rule between 29 May, 1999 – 29 May, 2003 under di Alliance for Democracy party (AD). Ayo Fayose become di next govnor between 29 May, 2003 – 19 October, 2006 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) to become di second elected civilian govnor of di State. Di state assembly later impeach Fayose on October 16 afta e chop accuse of money mago-mago say e embezzle funds, dem later replace am wit di state Speaker Aderemi but federal goment declare say di move dey illegal. General Tunji Olurin (Rtd) become di state administrator from 19 October, 2006 – 27 April, 2007 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) afta dem declare state of emergency for di State. Chief Tope Ademiluyi become Acting Governor for 27 April, 2007 – 29 May 2007 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) Engr Segun Oni become Governor for 29 May, 2007 and rule till 17 Feb, 2009 under di flagship of di Peoples’ Democratic Party (PDP) before Appeal court remove am based on illegal returns of April 2007 elections. INEC later organise a partial re-run of di election. Rt. Hon. Tunji Odeyemi step in as acting govnor between dis period from 17 February, 2009 – 6 May, 2009 di under Peoples’ Democratic Party (PDP). Im become acting govnor wen one appeal court wey sit for Ilorin, Kwara State nullify Segun Oni election and order rerun poll inside 10 out of di 16 local councils wey dey di State. Dr. John Kayode Fayemi become govnor of di state for 16 Oct, 2010 – 16 Oct, 2014 under di All Progressive Congress (APC) Mr. Ayodele Fayose become govnor of di state for di second time for 16 Oct, 2014 – 16 Oct, 2018 under di Peoples’ Democratic Party (PDP) Dr John Kayode Fayemi win Ekiti State election again for 15 July, 2018 to lead di state and im tenure end for October 2022.

Source: BBC