One small pikin for Ghana wey im name na Ace Liam don become di Guinness world record holder as di youngest artist.
Ace Liam wey begin dey paint at 6 months old, attempt im record at di age of 1 year 4 months old.
Di existing record bifor now bin set in 2003 for di US by Dante Lamb wen im dey 3 years old.
Dante im abstract paintings don dey hang for di monkey love dessert bar for Georgia.
Im don sell im first piece on 6 October 2003 for $85 (£50).
But five months afta Ace Liam im attempt, Guinness world record don confam say im get di current record.
For one press conference, im mama tok say dem receive email wey confam say Ace Liam don beat di record.
“Afta five months of anxiety Guinness world record tok on 13 May say Ace Liam don win di record,” Ace im mama Chantel Kuukua Eghan tok.
“We dey happy to inform you say your application for di youngest artist (male) dey successful, you now be di guinness world record title holder.”
“You dey eligible for one complimentary certificate, congratulations! You dey officially amazing,” di email wey Guinness world record send to Ace im mama tok.
Ace Liam mama add say di achievement na “remarkable wey e dey confam di talent of di pickin wey dey young like Ace. Dis na inspiration to oda artists say dem fit to do am no mata dia age”.
Some of patrons for di US and UK buy some of Ace Liam im paintings.
First Lady of Ghana, Rebecca Akufo-Addo don receive one of di pickin im paintings.
“Dis na inspiration say small pickin like Ace fit to attempt dis record. Dis na evidence say every pickin gatz to dream.”
Chantelle also explain say im make di application to attempt di record around di time Nigerian chef Hilda Baci don break di longest cooking record.
“I don dey motivated afta Hilda do am, na so I check di guinness page to see wetin I fit attempt.”
“As I see dis one, wey I tok myself say my pickin fit do am. Dis way im go grow into di art world den inspire odas wey dia mama and papa no wan make dem do arts,” Chantelle explain.
Chantelle also explain say she make di application to attempt di record around di time Nigerian chef Hilda Baci don break di longest cooking record.
“I don dey motivated afta Hilda do am, na so I check di guinness page to see wetin I fit attempt.”
“As I see dis one, wey I tok myself say my pickin fit do am. Dis way im go grow into di art world den inspire odas wey dia mama and papa no wan make dem do arts,” Chantelle explain.
One-year old Ace Liam get support of di First Lady of Ghana, Rebecca Akufo-Addo, for im record attempt
Ace Liam sell all im paintings for di soundout exhibition