BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Earthquake happun for Kenya? Wetin we know

Screenshot 2024 07 17 094700.png Several pipo for Kenya dey in fear overnight sake of di earthquake wey touch some parts of di kontri

Wed, 17 Jul 2024 Source: BBC

Several pipo for Kenya bin dey in fear overnight sake of di earthquake wey touch some parts of di kontri and damage structures.

Di residents across Nairobi begin dey fear on Tuesday night wen different structures for some areas dey affected by di tremor.

Local media report say di tremor movements bin affect areas like Kitengela, Ruaka and Westlands.

Residents for areas like Isinya, Kajiado, Kirinyanga, Kisii and Nyeri also experience di earth tremors wey make some parts to crack.

According to Volcano discovery wey dey monitor global earth tremors for di world, "di magnitude of 4.6 earthquake hit 87 km (54 mi) away from Nairobi."

Dem add say di earthquake get shallow depth of 10km (6 mi) and e affect several parts of di area.

Shallow earthquakes dey more strongly dan di deeper ones as dem dey closer to di surface, according to Volcano discovery.

Dey add say di earthquake fit cause objects to fall to di ground, e fit break windows and oda tins

Wetin be earthquake and how e dey happun

Na thousands of earthquakes dey happun across di world evriday but some fit dey so small wey be say you fit no quickly see am except dem use specialist equipment.

Meanwhile, oda earthquake fit dey so high wey be say e go destroy towns and cities.

Earthquakes dey happun wen earth plates move for different directions ova long periods of time.

For 2023, similar earthquake bin happun for Morocco wia ova 1,400 pipo bin ey affected.

Di strong earthquake of magnitude 6.8 strike central Morocco.

Di interior ministry for Morocco bin say more dan 1,400 pipo get serious injuries, and di heaviest casualties dey for provinces just south of Marrakesh.

As e be say dem dey fear aftershocks, many Moroccans decide to stay outdoors for a second night, as dem sleep for di streets.

Wia e happun main-main na di High Atlas Mountains, 71km (44 miles) south-west of Marrakesh, at a depth of 18.5km, di US Geological Survey tok.

Source: BBC