BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Earthquake in Morocco don kill 632 pipo

93218700 Some damage of the di earthquake

Sat, 9 Sep 2023 Source: BBC

One strong earthquake of magnitude 6.8 strike central Morocco, killing at least 632 pipo, di kontri interior ministry tok.

Wia e happun gan-gan na di High Atlas Mountains, 71km (44 miles) south-west of Marrakesh, at a depth of 18.5km, di US Geological Survey tok.

Di quake strike on Friday night at 23:11 local time (22:11 GMT). 4.9 aftershock bin dey 19 minutes later.

Pipo die for Marrakesh and several areas to di south, di ministry tok.

Di believe na say many of di pipo wey die dey live for remote areas.

Di interior ministry say di earthquake kill pipo for di provinces and municipalities of al-Haouz, Marrakesh, Ouarzazate, Azilal, Chichaoua and Taroudant, adding say at least 329 pipo also wunjure.

Unverified video clips on social media show damaged buildings, oda buildings wey dey shake and streets wit plenty collapsed buildings.

Source: BBC