BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Eight die, sixty injure for India train crash

Screenshot 2024 06 18 154144.png Di accident take place for West Bengal New Jalpaiguri area on Monday morning

Mon, 17 Jun 2024 Source: BBC

Eight pipo don die and around 60 injure from one train crash in di eastern Indian state of West Bengal.

Di accident happun wen one train wey dey carry load hit stationary passenger train, for Kanchenjungha Express, in di New Jalpaiguri area on Monday morning.

Dramatic visuals from di accident site show one wagon of di express train as e suspend in di air.

Authorities tok say e fit be say na "human error" cause di crash and dem go hold detailed investigation.

Officials tok say ambulances and disaster teams wey dem send to di site for rescue efforts arrive afta di accident happun at 08:55 local time (03:25 GMT).

State Chief Minister Mamata Banerjee express im shock at di accident and e tok say sem go take action on "war footing".

Pipo wey die include di driver and di assistant driver of di train wey carry load and di guard of Kanchenjungha Express.

"We don complete rescue," Jaya Varma Sinha, CEO of the Railway Board, tell tori pipo.

Dem dey treat di injured for medical college for Siliguri city, she tok. "Our first priority for dem na to get di best medical aid possible."

Railway official Sabyasachi De tell tori pipo say "di preliminary information we get be say di train wey dey carry load hit Kanchenjungha Express from di rear". E add say dem go confam di reason for di crash afta investigation.

Ms Sinha tok say e be like say na human error cause di accident. "As per initial investigation, e be like say driver of di goods train disregarded di signal."

She add say Kavach, one automatic train protection system, wey di Indian Railways develop, gatz dey planned and expanded for West Bengal state.

One police official tell reporters say di engine of di goods train don spoil while three coaches of di express train don derail.

One rescue official tell di Times of India say dem avoid to use gas cutters during di relief efforts becos e fit endanger di lives of pipo wey dey trapped in di train.

E tok say relief efforts dey slow becos of di heavy rain in di area.

Federal Railway Minister Ashwini Vaishnaw tok say relief teams don work in close coordination wit railway officials to carry out rescue operations.

Di minister tok say e don travel to di accident site.

Prime Minister Narendra Modi call di incident "saddening" and e don tok to officials about di rescue efforts.

"Condolences to di pipo wey lose dia loved ones. I pray say di injured recover soon," e write on X.

E announce compensation of 200,000 rupees ($2,394, £1,890) for di families of pipo wey die and 50,000 rupees for each of di injured passengers.

Di railways don set up control desk wit helpline number for Rangapani station, near wia di collision take place.

Last year, one devastating crash involving three trains in di eastern state of Odisha don kill around 290 pipo and leave more dan 1,000 injure.



One wagon of di Kanchenjungha Express suspend in di air afta goods train ram into am

Source: BBC