FBI place $10,000 bounty on Olumide Adebiyi Adediran
Di Federal Bureau of Investigation (FBI) don announce reward of up to $10,000 (about N14m) for information wey go lead to di arrest and conviction of Nigerian citizen wey dem identify as Olumide Adebiyi Adediran, wey bin japa more dan 20 years ago.
FBI yarn dis one inside one statement for dia website on Wednesday 24 September wia dem say Adediran bin japa from di Central District of Illinois for late December 2001, just bifor im federal trial bin dey scheduled to begin.
E bin dey face multiple charges including bank fraud, identification document fraud, and credit card fraud.
"Olumide Adebiyi Adediran dey wanted for Violation of Conditions of Release. For August of 2001, Adediran bin allegedly enta one bank for Champaign, Illinois, and attempt to retrieve funds from one deposited fraudulent check.
"E bin also allegedly use stolen information of United States citizens to open bank and charge accounts. Adediran bin japa from di Central District of Illinois at di end of December 2001, shortly bifor im trial for di Central District of Illinois bin dey set to begin on federal charges of bank fraud, identification document fraud, and credit card fraud," di statement tok.
FBI say for January 2, 2002, one federal arrest warrant bin dey issued for Adediran for di United States District Court, Central District of Illinois, Urbana, Illinois, afta e chop charge of Violation of Conditions of Release.
Dis no be di first time FBI go dey declare Nigerian citizens wanted for fraud.
Afta dem declare am wanted and e chop arrest for December 2024, one Abiola Kayode bin dey extradited to Nebraska, US, to face prosecution for cyber fraud.
FBI bin allege say Kayode bin participate for inside one yahoo-yahoo business wey defraud pipo for Nebraska and oda places of more dan $6 million (8,952,566,160 naira).
"Kayode, wey dey on FBI Most Wanted Cyber Criminal List, dey alleged to follow for one Business Email Compromise (BEC) scheme from January 2015 to September 2016. Di BEC scheme bin scam businesses for di District of Nebraska and elsewhere of more dan $6 million."
For April 2025, FBI say dem arrest 22 cybercrime suspects, wey dey sexually blackmail and extort US minors.
Di Bureau ontop dia website tok say di arrest na part of "Operation Artemis", one international operation wey dem launch for 2023, to fight di growing threat of sextortion among Nigerian-based sextortion rings.
Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) in collaboration wit FBI conduct di investigation wey lead to di arrest of di suspects involved in di sextortion scheme.
Di agency tok say among di 22 suspects, approximately half of dem dey directly linked to victims wey kill demsefs.
"Dis operation na step in di fight against child exploitation, bring justice and accountability to international perpetrators wey dey hide anonymously behind screens," FBI tok.