Menu

Facelift at 28? Why young pipo dey run go do plastic surgery

Hgnxvb.png Foto of Emily, during her recovery and post-surgery, she say she no dey regret her operation

Mon, 13 Oct 2025 Source: BBC

Plastic surgery to get facelift don dey enta new territory.

One quick search on socials and my feed full wit posts from pipo wey dey dia late 20s, 30s.

Dem dey discuss different types of facelift - di mini, di ponytail, di deep plane.

Di day wey dem bin dey reserve facelifts for old pipo wey dey wealthy don pass - now di number of younger pipo wey dey choose to go under di knife don increase.

Belle dey sweet some of dem as dem dey share pictures of dia face before and after. Dem dey also share di very bruised bit in between - wey be dia very painful recovery.

Celebrities like Kris Jenner, Catt Sadler and Marc Jacobs bin don tok openly about dia treatment. Rumour dey fly upnadan say many odas don do facelift.

Pipo dey always see facelift as di last hope, di most major of cosmetic surgeries.

Di question here na weda pipo dey become so insecure evritime for inside di fake online world or dem go just pay thousands of money for di operation?

Or maybe we bin don get so many non-surgical treatments, like Botox and fillers, wey dem go peel skin from our cheekbones and our facial tissues and dem go rearrange di fats wey feel like say e dey logical - and e dey last longer - wetin be di next step?

For Emily, wey bin don do facelift wen she bin dey 28 years, she do am sake of say she bin wan get dat " wow look" - sharp jaw wey be like wetin dey mould well, high cheekbones and fox eyes.

She say to go Turkey go do her surgery na "life-changing" experience and she no dey regret am.

"In total I bin do six surgeries wey dem join into one," she explain. "Among dem I bin do a mid- face lift, lip lift and rhinoplasty [nose job]."

Wen she dey describe di process, di businesswoman from Toronto, Canada, say di surgeon bin dey play her favourite song wen dem bin give her di anaesthetic and den: "I begin asleep and wen I bin wake up, I vomit, and I kon see new face and new nose."

Di recovery process long well0-well - di pain and bruising start to dey reduce afta di first few weeks, but e bin take six months for Emily to start to feel some parts of her cheeks.

She go like do am again? She shake small.

"Since my surgery, I bin don change my life. I dey healthier, I dey drink less, now, I dey look afta my skin, I sleep. I tink say, like say I bin know wetin I sabi, e be like say I for no go through am"

"My mama no even know until I tell her some days afta di surgery."

But den she stop kon begin reflects.

"But I bin wan just be di best version of mysef," Emily tok "and now I tink say I don become am."

Figures from di British Association of Aesthetic Plastic Surgeons (BAAPS) show say facelifts don increase by 8% over di past 12 months for di UK - dem no break down di figures by age, but many members report say di demographic dey shift.

Dis also show for oda parts of di world, wit di American Society of Plastic Surgeons wey dey see as e dey rise for di Gen X (wey dey between 45 to 60) wey dey choose facelift.

Nora Nugent, president of BAAPS, beliv say plenti reason dey wey dey cause di change - including di rise of weight-loss medications.

"Losing weight so quickly wit dis drugs fit leave plenti excess skin. Facelift fit help you wit am," she tok. "Techniques don develope well-well - facelift no mean to risk dat 'wind tunnel' again [over stretched face sake of di skin wey don pull back] effect on di face wey we bin dey see many years ago."

However, facelift still be significant operation wey only specialist suppose do, registered plastic surgeon for facility wey dey registered facility and wey also get proper equipment, she tok.

For im clinic for Bristol, consultant plastic surgeon Simon Lee don do hundreds of facelifts - and e show me video of one.

For di duration of di procedure di client bin dey wide awake, sake of low levels of local anaesthetic wey dem bin inject into di skin and di deeper tissue wey dey under.

Im do some small small marking for her face, before im go under di skin, di fat and di superficial fascia (SMAS) - di part of di face wey dey controls our expressions - den im go reach di deep plane wia im go reposition di tissue and muscles to reshape di face.

As im finish, di client, wey don go under di knife for four hours, smiles in relief.

One of di reasons why pipo dey like am , Mr Lee say, na how e dey easy for di surgeons to lift di face and neck.

Before, you go need hospital theatre and wey require general anaesthetic, but now im dey do face and neck lift without sleeping injection or medications for im clinic.

Na "exciting time" for me for dis industry, im tok, wit di kain developments wey dey happun wit speed. While di classic facelift - wey dey focuse on di lower jaw and neck still dey popular, e get newer sets of treatments wey dey target di upper two thirds of di face - wia im say di ageing process dey start from and e dey noticeable at a younger age.

Di surgeon give condition as im say facelift dey suitable for pipo wey dey over 40, but e go dey unusual to carry out such dat kain complex procedure on someone wey dey dia 20s and 30s.

risks and complications dey involved for dis kind of procedures, like developing hematoma - wey be collection of blood under di skin wey if dem no treat am well, e fit lead to necrosis (death of surrounding tissues), infections, nerve injury and alopecia.

Facelift dey costs, on average, £15,000-£45,000 for di UK, but e get clinics wey dey do dis procedures for as little as £5,000.

Experts say e dey important to do your research and choose di plastic surgeon wey specialise on facelifts.

Julia Gilando, wey dey 34 years, decide say she bin need facelift to fix asymmetry for her face afta she bin get issues wit di jaw alignment earlier for her life.

Although many of her friends say dem no see any problem wit her face, she bin feel say, she "trust her mind", and she bin fly go Turkey for her procedure, wey cost $8,000 (£6,000).

Despite warnings about di risks wey dey associated wit cosmetic surgery for Turkey increase well-wellsake of say many pipo dey reduce di price.

"At first I bin tink say dis whole idea dey crazy, but I bin do my research and I decide to go for am," Ms Gilando, one healthcare professional, tok. "I bin dey fear, I bin dey for foreign kontri, I bin dey alone, and I no sabi speak di language.

"Afta my surgery I bin spend two days for hospital and den i need to provide for myself. I eyes bin swell, i bin no fit see.

"Some dark times bin dey, na a whole mental rollercoaster of emotions e be for me dat time, you go oass through dis highs and lows."

Concerns from researchers about weda such cosmetic surgery procedures dey give di self-esteem and confidence wey di industry dey advertise.

"I tink say plenti pressure dey," Dr Kirsty Garbett, wey be body image expert from di Centre of Appearance Research for di University of West England, explain. "Especially wen e comes to di face - we see ourselves for video calls, social media platforms, we compare ourselves to oda pipo easily."

And she say, what wetin we dey see no necessarily be true reflection of reality.

"AI, filters - all of dem dey play dia part to create fake online world. And, at di same time, we dey see di rise to make cosmetic procedures normal."

Celebrities wey dey tok well-well say dem don do dis operations, in some ways, na good tin, she tok, but e dey also normalise dem - e dey make dem appear "just as part of life and e dey make us really worry".

Caroline Stanbury, TV presenter and one of di Real Housewives of Dubai, bin do facelift two years ago wen she dey 47, even wen evribody bin dey tell her make she no do am sake of say she bin dey too young.

"Na di best tin wey I don ever do," Caroline tok. "Why I want wait until I enta my 60s, wen I go kon dey desperate and need it? I want to look and feel amazing now."

Afta she bin don spend 20 years to do regular Botox and fillers, she bin feel like she don "begin to look somehow". She bin pay $45,000 (£34,000) for deep plane facelift for di US.

"I still look like me, and dis procedure don give me anoda 20 years to feel great," she tok.

Alexis Verpaele, wey be plastic surgeon wey dey base for Belgium, wit clients from all over di world including di UK, say im dey worried about di increasing number of younger pipo wey dey come for di treatment.

Im dey tok to dis clients evritime about ways wey dem fit achieve certain looks without sometin wey dey like major surgery.

"If dem do facelift for dia 20s, and we know say e fit last for 10, 15 years.

"So by di time dem dey 60, dem fit don do like three facelifts," De Verpaele tok.

"Na plenti trauma be dat for one face to endure - and na di best case scenario without any complications."



Caroline Stanbury describe her facelift as di "best tin" wey she bin do



Julia Gilando travel go Turkey for her surgery

Source: BBC