BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Family of Onyeka Onwenu dey lay singer to rest

Screenshot 2024 08 30 170832.png The late Nigerian singer, Onyeka Onwenu

Fri, 30 Aug 2024 Source: BBC

Family of Nigerian singer Onyeka Onwenu dey lay di singer to rest on Friday, 30 August for Lagos, southwest Nigeria.

Onyeka wey also be songwriter, actor, journalist, activist, and politician, wey die at di age of 72.

Her funeral service dey currently hold for di Fountain of Life Church Ilupeju and burial go hold for one private vault for Ikoyi.

Meanwhile, President Bola Tinubu bin extend im profound condolences to di family of di late Ms. Onyeka Onwenu.

According to one statement wey Ajuri Ngelale, Tinubu tok-tok pesin, release on Wednesday, di president remember many artistic interventions of di late musical icon in promoting public good.

"President Tinubu celebrate di life of di versatile and extremely gifted artiste wey apply herself to di whole gamut of artistic enterprise and expression, bringing joy and laughter to many.

"Di President condole wit di entertainment industry, di Imo State Government, and di numerous fans of di departed star over dis immeasurable loss," di statement tok.



Early Friday morning, di bodi of late Onwenu arrive for di Fountain of Life Church for Lagos.

Source: BBC