About five pipo don die for di shooting wey happun for one school for Madison, Wisconsin, United States.
Di shooting leave multiple pipo wit serious injury, according to di police.
Also, di Madison police chief say officers for di scene bin "locate a juvenile wey dem tok say fit dey responsible" for di shooting.
According to di police, di attack take place only 3 miles (4.8km) from a police training centre.
Di police chief, Shon Barnes, say dem find di pipo wey die inside di school building.
Wen dem find dose wey don dey injured, officers immediately begin to administer "life-saving efforts" for di wounded, according to di police chief.
"Dem leave di training centre and begin to do real-time wetin dem don actually practise".
Police say dia officers no fire any weapon wen dem arrive di location of di shooting.
Di police chief say officers believe say di suspected attacker na student for di school.
Officers bin respond to a shooting for Abundant Life Christian School for di state capital, Madison.
"Multiple injuries dey reported," di Madison Police Department write on social media. "Dis remains an active and ongoing investigation. More information go dey available."
Dem also ask make residents to avoid di area and roads dey closed close to di school.
Di school request for prayer
Di Abundant Life Christian School (ALCS), wia di shooting bin happun don ask di public to pray for dem.
"Prayers Request! Today, we get an active shooter incident for ALCS," di school post for Facebook.
"We dey di midst of following up. We go share information as e dey."
"Please pray for our Challenger Family," di statement tok.
Wisconsin govnor dey 'closely monitor' di shooting
Di Wisconsin govnor Tony Evers say e dey closely monitor di incident.
"We dey pray for di kids, educators, and entire Abundant Life school community as we await more information and dey grateful for di first responders wey dey work quickly to respond," e write on X.
How many school shootings happun for di US?
Shootings dey common for di US, and schools no get any exception.
Di K-12 Violence Project, run by researcher David Riedman, bin count more dan 300 dis year alone.
Dose statistics include all incidents wia a gun dey brandished or fired, or a bullet hit school property for any reason, regardless of di number of victims, time, or day of di week.
Di news organisation Education Week say 38 school shootings don result in deaths or injuries across di US so far dis year.
E get a total of 69 victims - including 16 deaths - bifor today shooting.
I am closely monitoring the incident at Abundant Life Christian School in Madison. We are praying for the kids, educators, and entire Abundant Life school community as we await more information and are grateful for the first responders who are working quickly to respond.
— Governor Tony Evers (@GovEvers) December 16, 2024