BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Flights dey grounded for Kenya main airport as workers protest against goment deal

Screenshot 2024 09 11 151730.png Last week, airport workers bin threaten to go on strike

Wed, 11 Sep 2024 Source: BBC

Hundreds of passengers dey stranded for Kenya international main airport afta airport workers go strike over one planned takeover by one Indian company.

Passengers stand for long queues outside as dem dey wait in front of closed door for di Jomo Kenyatta International Airport (JKIA) on Wednesday morning.

Di aviation workers union dey oppose Kenya goment proposal to lease Jomo Kenyatta International Airport (JKIA), for Nairobi give Adani group for 30 years.

Afta union members walk out on Wednesday morning, airlines delay plus cancel flights.

But di goment defend di proposal, say di airport dey operate beyond capacity and dem need private investment to upgrade am.

For one statement, JKIA say: "As of 7:00am, minimal operations bin resume. In di meantime, we dey discuss wit relevant parties to normalise operations. We apologise for any inconvenience wey dis cause and appreciate your patience and understanding during dis time."

Hundreds of workers begin demonstrate on Wednesday as planes remain grounded.

Di goment bin tok say di build-and-operate agreement wit India’s Adani Group go see di Jomo Kenyatta International Airport renovated, and and go ensure additional construction of runway and terminal, in exchange for di group running di airport for 30 years.

Kenya Airport Workers Union wey announce di strike say di deal go lead to job losses and “inferior terms and conditions of service” for dose wey go remain.

Kenya Airways on Wednesday announce say flight delays and possible cancellations go dey sake of di ongoing strike for di airport, wey dey serve Nairobi.

Last week, airport workers bin threaten to go on strike, but di plans bin dey called off pending discussions wit di goment.

Di spotting of unknown pipo moving around wit airport officials taking notes and photographs bin raise concerns say di Indian firm officials bin dey ready for di deal, local media outlets bin report last week.

Di High Court on Monday temporarily stop di implementation of di deal until a case filed by di Law Society and di Kenya Human Rights Commission dey heard.

Source: BBC