Menu

Full list of kontris wey don qualify for di 2026 Fifa World Cup and all you need to know

Hfhk..png Dis go be di longest World Cup for history

Thu, 16 Oct 2025 Source: BBC

Di 2026 Fifa World Cup go host 48 teams for di first time and all di kontris wey qualify don dey sabi diasef.

Na di first time wey di World Cup tournament go dey hosted by three different nations be dis - di tournament go take place for di United States, Canada and Mexico.

Kontris across Africa, Europe, Asia, North America and many odas don sabi dia place for di World Cup and na preparation remain.

For instance, England bin seal dia place for di 2026 World Cup wen Thomas Tuchel side defeat Latvia to qualify wit just two games to spare.

Di likes of Ghana, South Africa and Cape Verde don qualify from Africa. While on di oda hand, some countries go still gatz wait for di play-offs.

Di opening match of di Fifa World Cup go take place for 11 June 2026 for Mexico City, while di final go take place for 19 July for New Jersey.

Di tournament go expand to 48 teams for di first time and sake of dat, e go last for record 39 days.

Di tournament don double for size since di last time di tournament hold for di United States, wen na 24 teams bin compete for di trophy for 1994.

Di new format go feature 12 four-team groups and extra knockout round - round of 32.

Di general admission tickets for di World Cup go split into four categories, wit matches for USA costing between $560 (£417) and $2,235 (£1,662).

Di cheapest ticket for di 2026 World Cup final go cost up to $2,030 (£1,510), and di most expensive go be $6,000 (£4,462).

Which country don qualify for di 2026 World Cup

England, Ghana and Brazil secured dia place for di World Cup tournament, along wit 25 oda teams.

Argentina, di world champions also dey among dose wey don qualify but e still get 20 spots to fill.

Di kontris wey don alreadi secure dia spot na:

Hosts: Canada, Mexico, United States.

Africa: Algeria, Cape Verde, Egypt, Ghana, Ivory Coast, Morocco, Senegal, South Africa, Tunisia

Asia: Australia, Iran, Japan, Jordan, Qatar, Saudi Arabia, South Korea, Uzbekistan.

Europe: England.

Oceania: New Zealand.

South America: Argentina, Brazil, Colombia, Ecuador, Paraguay, Uruguay.

Of all of dis countries, three bin qualify for di World Cup for di first time for dia history- di kontris na Cape Verde, Jordan and Uzbekistan.

One country wey dem call Suriname and Curiacao also dey hopeful to join di list of World Cup teams for di first time.

Some teams wey go win for di intercontinental play-off tournament wey go feature di winner of di African playoff go face di winners from Bolivia, New Caledonia and two teams from Central America, and one from Asia.

Na afta dem don play all di play-offs bifor di 48 teams go complete.

Di draw for di Fifa World Cup group stage go hold for Friday, 5 December, and e go take place for John F Kennedy Centre for di Performing Arts for Washington DC.

Which cities dey host 2026 World Cup matches?

Sixteen cities go host games during next Fifa World Cup - 11 cities for di United States, three for Mexico and two for Canada.

Dis na di 2026 World Cup host cities:

USA: Atlanta, Boston, Dallas, Houston, Kansas City, Los Angeles, Miami, New York/New Jersey, Philadelphia, San Francisco and Seattle.

Mexico: Guadalajara, Mexico City and Monterrey.

Canada: Toronto and Vancouver.

Source: BBC