L - Dr Omane Boamah (Defence minister) R - DR Ibrahim Murtala Mohammed (Environment minister)
Two ogbonge govment ministers don die togeda wit six oda pipo for helicopter crash for Ghana.
Di chief of staff Julius Debrah confam di death for one press conference.
"I gat di unpleasant duty to announce dis national tragedy wey happun for our kontri dis morning. Govment regret to announce di death of di following pipo for dis crash.
Dr Edward Omane Boamah (Defence minister)
Dr Ibrahim Murtala Mohammed (Environment, science and technology minister)
Dr Muniru Mohammed Limuna (Acting Deputy National security coordinator)
Dr Samuel Sarpong (Vice chairman of NDC)
Samuel Aboagye (Former parliamentary candidate)
Squadron Leader Peter Bafemi Anala
Flying Officer Twum Ampadu
Sergeant Ernest Addo Mensah
"Di govment don extend dia condolence to di family of dis pipo wey don die in service to di kontri.
"All flags go fly at half mast until further notice," di Chief of staff announce.
Armed Forces annouce earlier say di plane don miss
Di GAF helicopter Z9 wey dey go di Ashante region bin disappear from di radar, di Ghana Armed forces confam.
Inside one statement di Armed forces say "di GAF helicopter Z9 wey bin take off Wednesday morning at 9:12 AM from Accra bin dey go Obuasi don currently dey off radar."
"We dey do evritin to establish contact wit di helicopter at dis time."
Inside di statement Captain Veronica Adzo Arhin wey be tok-tok pesin for di Ghana armed forces tok say "na three crew and five passengers bin dey on board di helicopter as e don comot Accra."
For Obuasi for di Ashanti region, eye witnesses tok say one helicopter crash for di Adansi Amrofuom District, Wednesday morning.
Dem tok say di aircraft burn beyond recognition.
Profile of Dr Omane Boamah
Di late defence minister bifor im dead na defence minister for di kontri from di New Juaben South Constituency for di Eastern Region.
Im be medical doctor and health policy and financial planning analyst.
Dr Boamah bin dey graduate as medical doctor from di University of Ghana medical school wia im also attend di Washington University school of medicine for St. Louis, Missouri for di US.
Im dey hold masters' degree for health policy planning and financing from. Di Lonbdon school of Economics and di London school of hygiene and Tropical medicine.
During im school days, im be active for student politics wey im serve as di president of di National union of Ghana students (Nugs).
For im political career, Dr Omane Boamah between 2009 – 2012 serve as deputy minister for Environment, science and technology.
From 2012 – 2013, im serve as deputy minister for youth and sports under di late president John Evans Atta-Mills.
Ghana president for 2012 appoint am as im spokesperson at di time during im campaign.
Im also serve as communications minister for di first tenure of president John Mahama.
Profile of Dr Ibrahim Murtala Mohammed
Di late environment minister bifor im death na Member of parliament for di tamale central constituency for di Northern region.
Im be deputy information minister for di first tenure of president John Mahama 2013-2014.
Im also bin serve as deouty minister for trade and industry.
Dr Murtala Mohammed na trained teacher from di Tamale college of education.
Im get masters' degree for development planning and international relations and diplomacy from di Kwame Nkrumah university of science and technology
Im na muslim wia im dey married wit three children bifor im die.
For school, im serve as di general secretary of di all African students union for 1999 wia for 2009, dem bin appoint am as coordinator for di national youth employment programme.
Im first election to parliament happun for 2012 when di pipo of Nanton bin vote for him to represent dem.
Afta president Mahama bin win di 2024 elections, im appoint am again as minister for environment, science and technology.
Background of plane crashes
Di govment officials bin dey on di road to Obuasi to launch one govment programme di "responsible cooperative mining and skills development initiative" bifor di crash.
Ashanti regional minister Dr Frank Amoakohene wey finally attend di event sake of e dey happun for im region, tok di crowd say im gat to leave to attend to one emergency.
"If una no see me again for dis event, I bin dey rush to attend to one emergency wey don happun, me and di commanders and di local authorities go comot di event to attend dis emergency."
Di programme according govment na part of measures to address di illegal mining kasala for di kontri wey don destroy waterbodies and forest reserves.
Sources within di govment tok say di president dey scheduled to attend dis event but im reportedly get oda commitments wey make im di event.
For June 2012, on Nigerian freight jet bin crash for Ghana wey kill at least 10 pipo.
Di cargo plane bin dey try to land for di airport for di Ghana capital bifor im crash into cars and wit passengers for di streets.
For 25 June 2020, one military aircraft bin crash-land for Ganvuliga for di Kumbungu district of di Northern region.
One statement from di Armed forces tok tok pesin at di time Oga Aggrey- Quashie tok say "dem bin recover all four crew and four oda military personnel for di aircraft within minutes wit no fatalities and injuries."
For 19 March 2024, anoda military helicopter bin crash-land for one community for di Ahanta west municipal district of di western region.
For dat incident, 21 pipo bin dey inside di aircraft – assembly member for di area oga Thomas Dadzie at di time confam to local media network Connect FM say dem rush three pipo to hospital wey dem rescue three odas.