Godwin Asediba say di award na
Ghanaian journalist Godwin Asediba don win di 2025 BBC News Komla Dumor Award.
Di investigative reporter, filmmaker and news anchor, na di10th recipient of di accolade, im dey work wit TV3 and 3FM for Ghana. Im stories don also appear on several international broadcasters.
Di 29-year-old dey like to focuses on human-interest stories wit di aim to expose injustice and amplify di voices of marginalised communities.
Di award, now wey be a decade old, dem create am to honour Dumor, one Ghanaian journalist and presenter for BBC World News, wey die suddenly at di age 41 for 2014.
Im bin work very hard to bring a more subtle narrative of Africa to di world, wey represent a confident, savvy and entrepreneurial side.
"Komla legacy dey reminds us say we need to tell African stories wit depth, dignity and a fearless commitment to truth," Asediba tok.
To win di award no just be a "personal milestone" for di Ghanaian but also "na call to carry forward di spirit of journalism wey go inform, inspire and transform".
Di award judges say dem bin dey impressed by Asediba investigative work and im strong belief in journalistic integrity.
One story wey im particularly dey proud of na im investigation into one of Ghana largest mortuaries wey dey neglected, and dey create a public health risk.
Asediba now dey ready to travel to London wia im go spend three months to work wit BBC News teams across television, radio and online.
Im go also receive training and top BBC journalists go mentor am.
"Over di past decade, di Komla Dumor Award don help nurture some of Africa most talented journalists. Na privilege to watch dem grow and make a lasting impact, both inside BBC and beyond," BBC regional director for Africa Juliet Njeri tok.
"Dis 10th anniversary stand as a powerful testament to Komla Dumor enduring legacy: im passion for bold, authentic storytelling and to champion African voices go kotinu to live on."
As part of di placement, Asediba go travel to one country for Africa to report on one story wey we go broadcast to BBC global audiences.
Pipo wey don win di award bifor na Rukia Bulle, Paa Kwesi Asare, Dingindaba Jonah Buyoya, Victoria Rubadiri, Solomon Serwanjja, Waihiga Mwaura, Amina Yuguda, Didi Akinyelure and Nancy Kacungira, na di inaugural winner.
Last year, Bulle bin travel go Senegal to report on Baye Fall - one Muslim subgroup wey dia strong appearance dey make dem stand out.
A year bifor im death, Komla Dumor bin feature for New African magazine list of di 100 most influential Africans