Menu

Ghanaian dancehall artiste Stonebwoy warn social media bullies, featured songs wit Odumodu black and Duncan Mighty

Stone Bbbb.png Stonebwoy don collaborate wit plenty Nigerian and Jamaican artistes for im 15-year career

Fri, 25 Oct 2024 Source: BBC

International Afro-dancehall artiste from Ghana, Stonebwoy don tok say celebrities gatz begin to sue pipo wey don dey drag dem and dia reputation on top social media.

According to di multiple-award winning artiste, dat na di only way pipo go dey careful about some of di tins dem dey write on top dis social media wey dey affect celebrities.

Inside one exclusive interview wit BBC Pidgin, Stonebwoy explain say “some pipo fit say tins wey fit cut like knife, some fit tok di most horrible tins about pipo without evidence.”

Im add say “oda times, pipo don dey drag odas sake of hate, wey dey against social media rules.”

“If e become popular say celebrities go dey sue pipo for dis kind tin, sometin go change.”

Im comments come on di back of recent mata as Wizkid don throw shade for Davido as im announce say im dey drop new project.

Even though Davido neva respond to di drags, sabi pipo tink say wetin artistes gat to do na to collaborate no be to dey shade each oda.

Stonebwoy don gree wit dis opinion.

“As pipo dey drag celebrities, I fit relate sake of sometimes pipo just go bash you for no reason, odas just go lie put your top to create trend wey you neva fit respond,” di reigning Ghana artiste of di year tok.

Im add say “collaboration na wetin we gat to do as creative pipo, without dis, we no fit to grow di industry.”

Dis na one of di tins di “into di future” hitmaker chook mouth inside di interview as im release im sixth studio album.

“Up and Running album na mashup of all di influences wey make me Stonebwoy”

Afta im “Fifth dimension album” in 2023 wey feature multiple Grammy award-winning Angelique Kidjo and odas, Stonebwoy say im decide to take di rhythm a notch higher.

Dat album don win album of di year for di recent Ghana music awards.

Na so im cook anoda one wey di title na “Up and Running.”

One of di hit songs already na ‘jejereje’; song wey already bin dey trend for social media across kontris for Africa.

Stonebwoy tok BBC Pidgin say “I be epitome of music of black origin wia I get all my inspiration; like afrobeat, African music, dancehall/reggae, R & B, hiphop and di odas.”

“I dey do music wey don dey cut across all dis types, so I just cook full meal for my pipo on top dis album like I always dey do am.”

Di album get features wit Jamaican artiste Spice (Jiggle & whine), Ekelebe wit Oudumoudu black, Pray for me ft Wyclef Jean.

Anoda pesin wey feature on top dis album na legendary Nigerian musician and producer Duncan Mighty.

Stonebwoy tok BBC Pidgin say im don dey chase Duncan Mighty for collabo for long time.

“Duncan Mighty na legend for Africa, wey im dey creative; I don target am since, so as I create di song ‘Beta Tins’, in 2017, wey I sabi say na Duncan Mighty go dey on.”

Stonebwoy dey connect wit Nigeria on many levels

Stonebwoy don work wit at least twelve artistes and creatives for Nigeria.

Apart from Bruna Boy, Patoranking, Oudoumodu Black, Tiwa Savage, Banky W, Zlatan, Tekno, Seyi Vibez and odas, di ‘therapy’ singer get special relationship wit Davido.

“I dey love Davido as human being wey we dey relate for brotherhood level, na so Baba God don dey make tins work for our favour.”

Im add say “I go New York for some meeting s about dis album wey I hear say Davido dey US for im Puma event, so I call am wey I go dia to support am.”

“Na so as I enta room, OBO dey tok to di audience about Africa unity, na im see me for back wey im call me to di stage say make I tok my mind for dis Africa unity mata; so di brotherhood dey strong.”

Di two don collaborate on one hit song, ‘activate’ wey blow up across Africa, Stonebwoy say di two of dem go continue dia brotherhood for di industry.

Grammy dey expand to Africa - na good idea

In June dis year, Grammy announce say dem go expand to Africa and Middle East to support creatives thru “educational resources, intellectual property advocacy, cross-cultural learning among odas.”

Las las dey fit to organize Africa Grammy in 2027/2028.

Stonebwoy tink say “Grammy na powerful entity wey dey control di music landscape and di narrative sake of di power dey get for di world.”

Im add say “Grammy fit impact life sake of dem get ogbonge influence, once any African artiste win Grammy like dis, e mean say dem don go very far.”

Inside one article wey one writer don publish on top di Grammy website in August dis year, dem mention some musicians for Ghana wey contribute to one genre (hiplife).

Di list gat some of Ghana legends like Reggie Rockstone, Lord Kenya, Obrafuor, Tinny among odas, wia dey gat some musicians from di current generation.

Pipo like Black Sherif, King Paluta and odas, na so Stonebwoy respond say di writer “neva do due diligence” for dat article.

According to Stonebwoy, dey no fit to tok about Ghana music today wey dey neva go mention im name.



Di multiple award-winning artiste release im sixth studio album 'Up and Running' wey get some many pipo sabi as christmas anthem



Di 'therapy' hitmaker say celebrities gat to begin to sue pipo wey drag dem on top social media



Di reigning artiste of di year for Ghana say na collaboration go develop di industry for Africa



Fans don dey expect anoda song from di two artistes afta dia hit song 'activate' don blow in 2021



Grammy wey dey expand to Africa na good idea - Stonebwoy

Source: BBC