BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

Goment defend di N62,000 minimum wage proposal

Screenshot 2024 06 10 135646.png Joe Ajaero/Bola Tinubu/Festus Usifo

Sun, 9 Jun 2024 Source: BBC

Nigeria goment say dem and di Organised Private Sector don agree on N62,000 naira ($41 and £32) minimum wage for Nigeria workers.

For inside statement wey di Tripartite Committee on Minimum wage, wey don dey meet since to discuss about di new minimum wage mata, make recommendations afta dia meeting.

According to di statement, goment say dem don critically torchlight di National Minimum Wage and dem use " all necessary parameters".

Dem add say dem also apply social, economic and political considerations, relevant International Labour Organisations, Conventions and international best practices before di committee agreed on di N62,000 naira new minimum wage.

Nigeria Labour Congress (NLC) and di Trade Union Congress (TUC) dey demand for new minimum wage even before President Bola Tinubu enta office for 29 May, 2023.

Di workers and trade unions kontinu to push wen President Bola Tinubu announce say "fuel subsidy don go" during im inauguration for 29 May, 2023.

Dis announcement cause kasala for di kontri as fillings stations begin increase price, transportation go up wey lead to high inflation.

Organised Labour go on strike (Industrial action) for two days before dem call off to allow goment five days for tok-tok.

Oda tins goment consider as dem propose N62,000

According to di statement wey di Tripartite Committee release dem tok say, true true time don reach for an "upward review of di present National Minimum Wage" wey be 30,000 naira now since 2019.

Dem also agree say di advantages of di upward review of di National Minimum Wage outweigh di disadvantages.

"Diafore di Committee dey kindly invite Mr. President to note say di Committee adopt di motion as di proposal of N62,000 per month as di new National Minimum Wage afta dem consider all oda factors".

Dem also tell President Bola Tinubu to "note say di organised labour dey insist on N250,000 (Two hundred and fifty thousand) per month".

"Finally di Committee hereby presents N62,000 (sixty-two thousand naira) per month as agreed by Goment and Organised Private Sector (OPS) wit policy incentives and oda conditions wey di States and di Organised Private Sector make.

Dem also present di N250,000.00 (Two hundred and fifty thousand) per month wey di Organised Labour dey recommend as di new National Minimum Wage make President Bola Tinubu look into am.

Di Nigerian goment bin dey propose to add N18,000 to di current N30,000 national minimum wage, to make am N48,000 dis na according to di leadership of di organised labour.

But dis position far well well from di N615,000 wey di labour unions for Nigeria bin present to goment.

But goment believe sday wetin di labour unions dey propose as di new minimum wage no dey unrealistic.

Di national President of di Trade Union Congress, Festus Usifo, tok say N48,000 dey even lower dan wetin di least earning federal worker dey currently earn.

Remember say President Bola Tinubu bin announce a N35,000 wage award to federal workers from October 2023 until a new minimum wage go start.

E mean say di least personnel for di Nigeria civil service dey currently earn at least N65,000 monthly.

“Di goment proposal of a small N48,000 as di minimum wage na insult to di sensibilities of Nigerian workers and e also fall short of meeting our needs and aspirations," di NLC and TUC tok for a joint statement on Wednesday.

On Thursday, di Nigeria govnors forum, di group of all govnors for Nigeria bin bring statement say dem no go fit pay di N60,000 minimum wage.

"All tins considered, di NGF holds say di N60,000 minimum wage proposal no dey sustainable and can not fly. E go simply mean say many states go spend all dia FAAC allocations on just paying salaries wit nothing left for development purposes."

But on Friday afta di meeting dem agree on N62,000 naira.

Source: BBC