BBC

News

Sports

Business

Entertainment

GhanaWeb TV

Africa

Opinions

Country

How 21 pikin wey dey kidnap from Katsina farm regain freedom

31177284 Nigeria police logo

Sun, 6 Nov 2022 Source: BBC

Katsina State Police don announce di release of 21 pikin wey jaguda pipo bin kidnap as dem bin dey work for farm. According to statement wey di command bring come outside, di release bin happun on Saturday. Dem kidnap di pikin dem last week Sunday for one farm for di Mairuwa community, Faskari Local Goment Area for Kastina state. Di tok-tok for di command, Gambo Isah tok for statement, say, di pikins dem don reunite with dia families. E tell BBC say, "unofficially, we bin find out say di families bin pay di kidnappers 1.5 million naira to facilittate di release of dia pikin dem". Investigation don start on top di mata. E neva clear weda dem pay ransome for di release of di young pipo dem. Tori bin dey go up and down say di bandits bin ask for di owner of di farm to pay 30 million naira for dia release. No on Friday, di United Nations Children's Fund, Unicef bin hala ontop di mata say make authorities work wella and rescue di pikin dem. Say di mata of di kidnap dey 'reprehensible'. Di police bin report say of di 21 pikin, 17 bin de girls and di oda 4 boys.

Source: BBC